wetin I wan tell my people be say make we dey buy bitcoin and dey keep am any time wey we get money to buy bitcoin, some of us dey wait until somebody tell them say na now be the right time to invest for bitcoin before they go invest, so I no blame them because na the wey dem use know bitcoin
We need to blame dem oh because na dem dey give all this self proclaimed influencer mouth to dey talk, why you go wait for person to tell you to buy Bitcoin before you go buy, dem tell you say e get anybody wey fit talk when Bitcoin go increase or decrease. Anybody wey dey make speculation dey use general information wey dey available to everybody, dem no special or get any first hand information wey we fit no get and when you dey wait on them to tell you to buy or sell, na so dem go begin create telegram channel and dey charge you for wetin you fit yourself. You no dey trade so why you dey find when to buy or sell, all you need to do is to buy Bitcoin anytime you want and hodl.
Dey no dey plan to buy bitcoin or dey wait for one to tell you time before you go buy bitcoin, e get wetin I be wan make this our people understand for buying and selling of bitcoin, if you have for mind to buy bitcoin and invest you will buy bitcoin, but the thing be say many people dey wait until the precious time comes before them go buy bitcoin, but I dey let una know say bitcoin no get particular time wey you go buy am.
Actually dem dey plan to buy Bitcoin, you no go just rush anything for life. When you DCA you dey plan to buy Bitcoin, you can also target a price you want to enter the market and buy when the price reach that level. You can also not wait for that price so you don't miss buying Bitcoin. Different strategy dey to use invest inside Bitcoin so just do the one wey your money or body accept. But no go dey procrastinate or na you go regret am. For me I prefer to buy and wait instead of waiting to buy na just how my own be but others own can be different although at the end of the day, the koko na say we finally buy the Bitcoin as that's all that matters.