Bitcoin Forum
May 05, 2024, 04:17:17 AM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1] 2 3 »  All
  Print  
Author Topic: Hand work and skill or well paid government employee  (Read 402 times)
Bright0515 (OP)
Member
**
Offline Offline

Activity: 93
Merit: 22


View Profile
January 04, 2024, 05:01:32 AM
Last edit: January 04, 2024, 07:45:18 AM by Bright0515
Merited by CryptopreneurBrainboss (1), Hatchy (1)
 #1

Now wen I mean government employees I mean those that earn huge for instance the NNPC workers and many more as good as that.
Omo my country people now dey find sharp sharp money too much and many of them no even get the interest and the patient to learn hand work at all most of them see am like say na time wasting while some dey ready to even learn am but no supporting hand and me and you know say person wey wan learn work need to dey where him go dey alright in terms of wetin to chop.

Now make we look at factors wey fit hinder the learning of hand work
1, coming from a rich family: Today we come dey see am like say hard work come be poor man doings rich man pikin go reason say my family hold wetin I wan go learn work for abi that one no be stress for me.

2, poor background:Yes poor background too fit hinder person from hand work for our country now wen things cost pass as we dey see am how poor person wan take cope with registration buying of materials for work and others.

3, patience: concerning the situation of things for our country now many people no get the patience to wait for money at all so them rather go being an employee than to learn hand work and we all know say the way things dey for this our country if you no get strong back up for some place of work you dey at risk of being sacked at any given time.

But wen we look am for another angle how you see am wen be say person learn work for like 6-7 years you graduate but no get the money to open ur own to be on your own? And still consider the fact say as a government worker you no dey ur place them fit drop you at any time for u to go back to square one.
This point of mine no dey enough abeg if u get ur own experience or highlight do well to share with us.
It is a common myth that Bitcoin is ruled by a majority of miners. This is not true. Bitcoin miners "vote" on the ordering of transactions, but that's all they do. They can't vote to change the network rules.
Advertised sites are not endorsed by the Bitcoin Forum. They may be unsafe, untrustworthy, or illegal in your jurisdiction.
I_Anime
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 378
Merit: 157



View Profile
January 04, 2024, 05:22:29 AM
 #2

See normally we know Shey life nor easy, and we still know Shey wetting go work for Mr A might not work Mr B. Yes to learn hand work sharp normally and to school still nice. Some people don learn hand work Shey at the end e nor yield dem anything. like the way others wey learn that same thing tey dey gain am. And many people don still finish school but no work (nah this one common pass) but at first Una know Shey going to school nor guarantees Shey u go rich but nah to direct on the right path.
The truth is that anything you're doing in this life do it well either your learning hard work or schooling. Beside this crypto space as being a good side hustle for us. So as focusing on yah normal life still focus on this crypto space.

Y3shot
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 588
Merit: 164


Bitcoin👌 or nothing


View Profile
January 04, 2024, 07:02:53 AM
 #3

Nobody will see a good job that generates good money that will turn it down, the reason why most of us create job for ourselves is because their are no much job out there if you are looking for one and most times creating a job can be very financial stressful.  I think if I see a good goverment job with a good pay , I will go for it, save money to later establish a business that can bring more income for me . But the way the economy is going I think it is good for people to get skill .

Barikui1
Full Member
***
Online Online

Activity: 196
Merit: 123



View Profile
January 04, 2024, 07:21:25 AM
 #4

Bro to tell you the truth, no body go see better work come go learn handwork, you know why, good paying jobs go make you live a better and easier life, the stress wey come with handwork too much compared to higher paying jobs, and besides you fit dy work for that higher paying jobs and still run your business wey be plus too you.
 E dy really hard to see handwork person live large oo, but e dy very common for higher paying jobs workers.

Justbillywitt
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 238
Merit: 174



View Profile
January 04, 2024, 08:25:49 AM
 #5

If person wey learn work for 6 to 7 years come graduate and the person no come get money to establish him own shop. The person fit find another person shop where him go attach himself dey work for the time being and raise money wey him fit take open him own. Let's say the person learn how to barb hair, and he has no money to open him own barbing shop, him fit go meet another barber for the area and bargain with the person say make him attach himself here and be working. If they barb hair there #1000 he can be giving the owner of the shop #400 for every hair him cut. I think this way he can save money and set up his own.

Another option is that he can partner with someone who can open a shop for him and he work for the shop and give percentage with the owner of the shop. With time he can set up him own shop. Instead of saying no money and he let the skill he/she learnt to waste it's better to explore any of the above options I listed.  The problem we have in this part of the world is that everyone wants to be a boss of himself and nobody wants to be under somebody again.

███████ ███████        R O L L B I T        CRYPTO'S MOST INNOVATIVE CASINO        [ PLAY NOW ]        ███████ ███████
//     TRADE RLB NOW!     //
███████ ███████ ███████            OFFICIAL EUROPEAN BETTING PARTNER OF SSC NAPOLI           ███████ ███████ ███████
Richbased
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 294
Merit: 161



View Profile WWW
January 04, 2024, 08:26:15 AM
Merited by hugeblack (2)
 #6

See as life be like this eh make we dey find the money insap like now now as e dey hot no be to promise me billions next year instead dey give me #10k every week and forget about the billions wey I go get next year as no body knows wetin go happen that next year so as we dey find the sharp sharp money na in sure pass o person wey go carry money do better thing go do, the one wey go dey useless too go dey.

One man for my place him they sell razor blades for over 20 years now but come see the big and beautiful house wey him build with the razor blade business whereas e get some Agip, Shell and Total staffs Dem wey don dey work for years but dey never mould blocks talk more of building house all they do is spend huge amount in rented houses and apartments.

Learning a skill dey very important for our society because with the way things dey for our country, if you no get hand work e dey worry well well because e get time wey the place wey person dey take collect money normally go cease yet for some time den you fit dey use your hand work dey fetch small small money dey take sustain yourself for the main time.

To learn skill no too dey dependent on weda you come from rich background or poor background so far as say na skill wey go dey fetch small small money for you after you don learn am. If you no get money to pay to learn a skill den e get some of your relatives Dem wey get skills and get there own shop so you fit just meet them say make dem help you learn so base on say na relation something Dem go allow you to learn but the only problem be say a lot of people wey dey learn work from relatives no dey carry their head down base on say na person wey dem know and moreover dem no dey pay money to learn so Dem go dey behave anyhow.

The factor wey you list here wey be impatient na d tin wey dey worry many people wey dey learn skills now because some of them as soon as Dem don see say dey don learn one or two thing for the skill dey go dey feel like say dey don Sabi everything, dey go start to dey drop to come learn, sometimes dem go dey come ones in a month or week dey wont be taking the skill serious again instead of dem to settle down learn the skill well then get a certificate. This one na really big problem because I remember a time wey one man of God for our country carry some youths to go learn work for China, this guys never even spend 6 months Dem return back to Nigeria say dey don learn everything wen dey know nothing as Dem come back now to display wetin dem learn for China zero nothing to write home about. So being patient while learning a skill is very important because sometimes, e get some important things wey your tutor or trainer go hide from you till wen you don dey near to finish learning your skill so if you no dey patient you go miss am because he will not tell or show you till wen you are about to conclude your training so any body wey dey learn skill make him carry head down learn am very well so that him fit represent him master wen him no dey available.


Brainiac01
Jr. Member
*
Offline Offline

Activity: 70
Merit: 4


View Profile
January 04, 2024, 08:38:06 AM
 #7

I think it totally depends on the individual. For example, in my family I've always wanted to own a company (probably a tech company) and not work for anybody, so I tend to pursue this entrepreneur path unlike my younger brother who wants to have a job where he gets paid, live his life simple.
Egii Nna
Full Member
***
Online Online

Activity: 294
Merit: 159



View Profile
January 04, 2024, 09:37:43 AM
 #8

All you have just mentioned are actually factors that discourage some people from learning handwork, not knowing that a day will come when they will see the advantage of that handwork. To be precise, hand work now a days in Nigeria doesn’t need hard work only; you need to possess the ability to be smart. But that is what most of our people find hard to understand and think even if they try learning the handwork, they will end up getting nothing because many people have already engaged in the handwork they want to learn. If you are smart, even though thousands of people are doing the same handwork as you, if you create something new that almost all of them are doing the same work as you can’t do, you will achieve more than them.

But one thing I do consider as a factor that hindered some from learning this handwork is laziness, because if you are sure and you are ready to work, you will do all it takes to get what you want. As you mentioned earlier, some can’t engage in learning handwork because of their family background. I didn’t say it was not happening, but if you are ready to eradicate poverty in your family, you will engage, even if it is bricklaying or other construction work. You will gain some money and save some, which will help you to pay and buy some material to learn handwork.

To be sincere, handwork has done a lot for me so far. Because at first I learned male clothes sewing, when I was sure enough that I could sew the clothes well, I then engaged in learning female clothes. After that, I discovered that the number of people sewing in my area is greater than I thought. That is when I sit down and start thinking about something new that will bring me more money. That is when I start sewing joggers and hoodies. From there, almost all of the tailors in my area start looking for me so that I can teach them how to sew the joggers and hoodies. From there, the number of my customers decreased. That is when I start thinking about a new idea, which is now that I sew clothes, package them, and sell them as boutiques. At the same time, I started following some celebrities. When I see them with a new design, I will try to sew the same and sell it. If you are smart, you will achieve more with your handwork.

DaNNy001
Hero Member
*****
Offline Offline

Activity: 616
Merit: 509


Top Crypto Casino


View Profile WWW
January 04, 2024, 10:22:54 AM
 #9

Nobody will see a good job that generates good money that will turn it down, the reason why most of us create job for ourselves is because their are no much job out there if you are looking for one and most times creating a job can be very financial stressful.  I think if I see a good goverment job with a good pay , I will go for it, save money to later establish a business that can bring more income for me . But the way the economy is going I think it is good for people to get skill .
Well said brother, na the way the country be nai make people dey attach an extra skill or handwork to support them because if you follow only profession this country fit go fuck you and dem don fuck plenty people and the worse part come be say these people them no even get any hand work or skill to support them for the real world because if to say dem get dem for depend on the system to actually survive and as many people dey see the economy dey go na come dey cause many people to go secure second option to take survive.

█████████████████████████
████▐██▄█████████████████
████▐██████▄▄▄███████████
████▐████▄█████▄▄████████
████▐█████▀▀▀▀▀███▄██████
████▐███▀████████████████
████▐█████████▄█████▌████
████▐██▌█████▀██████▌████
████▐██████████▀████▌████
█████▀███▄█████▄███▀█████
███████▀█████████▀███████
██████████▀███▀██████████
█████████████████████████
.
BC.GAME
▄▄░░░▄▀▀▄████████
▄▄▄
██████████████
█████░░▄▄▄▄████████
▄▄▄▄▄▄▄▄▄██▄██████▄▄▄▄████
▄███▄█▄▄██████████▄████▄████
███████████████████████████▀███
▀████▄██▄██▄░░░░▄████████████
▀▀▀█████▄▄▄███████████▀██
███████████████████▀██
███████████████████▄██
▄███████████████████▄██
█████████████████████▀██
██████████████████████▄
.
..CASINO....SPORTS....RACING..
█░░░░░░█░░░░░░█
▀███▀░░▀███▀░░▀███▀
▀░▀░░░░▀░▀░░░░▀░▀
░░░░░░░░░░░░
▀██████████
░░░░░███░░░░
░░█░░░███▄█░░░
░░██▌░░███░▀░░██▌
░█░██░░███░░░█░██
░█▀▀▀█▌░███░░█▀▀▀█▌
▄█▄░░░██▄███▄█▄░░▄██▄
▄███▄
░░░░▀██▄▀


▄▄████▄▄
▄███▀▀███▄
██████████
▀███▄░▄██▀
▄▄████▄▄░▀█▀▄██▀▄▄████▄▄
▄███▀▀▀████▄▄██▀▄███▀▀███▄
███████▄▄▀▀████▄▄▀▀███████
▀███▄▄███▀░░░▀▀████▄▄▄███▀
▀▀████▀▀████████▀▀████▀▀
Churchillvv
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 392
Merit: 166


Eloncoin.org - Mars, here we come!


View Profile WWW
January 04, 2024, 04:37:32 PM
Merited by CryptopreneurBrainboss (2)
 #10

Having a skill is as good as getting a government or non-government-paid job, but it's all about individuality. I might love to work for the government, and you might want a self-employed job. The situation in our country has shifted the quest for jobs to a skill interface, but the truth is that whatever makes you comfortable should be what you most go for because there is no amount that any job can pay you monthly that your skill cannot pay you.

These two categories of jobs have both disadvantages and advantages, so we just have to choose the one that we are most comfortable with. For me, I just prefer handwork to government employment because I control everything that happens around the business. In fact, let's say I like freedom, so it depends on the individual.

Among the 3 factors you mentioned, they are all correct from your perspective, but from my view, a poor background doesn't hinder anyone. learning their desired skills because there are skills that you don't need to register to learn, or you can just adopt the method of the Igbo tribes to serve for a few years and get your desired skills and business ready.

rachael9385
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 448
Merit: 300



View Profile WWW
January 04, 2024, 04:39:35 PM
 #11

Nobody will see a good job that generates good money that will turn it down, the reason why most of us create job for ourselves is because their are no much job out there if you are looking for one and most times creating a job can be very financial stressful.  I think if I see a good goverment job with a good pay , I will go for it, save money to later establish a business that can bring more income for me . But the way the economy is going I think it is good for people to get skill .
Well said brother, na the way the country be nai make people dey attach an extra skill or handwork to support them because if you follow only profession this country fit go fuck you and dem don fuck plenty people and the worse part come be say these people them no even get any hand work or skill to support them for the real world because if to say dem get dem for depend on the system to actually survive and as many people dey see the economy dey go na come dey cause many people to go secure second option to take survive.
Keep the country outside, e still dey good for a good citizen of any country to get any skill at all because we know say person no dey younger forever and even if say you dey work for any company either oil company or and construction companies, if you done reach the age of 60 them go retire you and pay you off (like millions of naira or dollars).
And you know with your skills, if you done retire from work and you still dey active to do other works, either you start business with your pension money or you use the pension money take put your skills to work
Although, this matter we no go fit keep am outside from this discussion because really really this country done open a lot of people eyes to know say skills still dey good for many people to go learn them, and watin the Op dey talk still dey right

R


▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄
████████████████
▀▀▀▀█████▀▀▀█████
████████▌███▐████
▄▄▄▄█████▄▄▄█████
████████████████
▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀
LLBITCRYPTO
FUTURES
[
1,000x
LEVERAGE
][
.
COMPETITIVE
FEES
][
INSTANT
EXECUTION
]██████
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██████
████████████████████████████████████████████████████████
.
TRADE NOW
.
████████████████████████████████████████████████████████
██████
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██████
Ruttoshi
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 322
Merit: 272


Baba God Noni


View Profile
January 04, 2024, 05:26:19 PM
 #12

Skill and education together go well at leat you go know say na you go be hot cake for the labour market because if e come to degree work, you dey and when e come to skill work you also dey available. Some people the school wet them go na skill them to learn but them come back am up with their school certificate to make them professional. Even for the NNPC wet you dey talk, them get technical department, electricians, technicians and some other technical field people dey there. Na e make you see say some people dey prefer to go polytechnic so that them go learn both skill and the book side come graduate with certificate.

If you no won go school, the beat time to learn skill na when you just finish college, when you still set with you parents so that you no go lack shelter and food, your own na just to concentrate on your work to learn am know am well. But if you son already be family man or na you dey fend for yourself, he go somehow dey very stressful to learn skill. Learn skill at young age so that as you dey grow up, you dey get more experience for the skill. Hungry no dey catch people wey learn skill because no how wey the country hard reach base on no job, individual go need their service. My friend na graduate but God help am say he use community chance go work for shell wey he learn iron bending, na wetin he dey use take care of him family as he no get government work or company work because everyday people dey build house and them mist need him service.

.
Duelbits
▄▄█▄▄░░▄▄█▄▄░░▄▄█▄▄
███░░░░███░░░░███
░░░░░░░░░░░░░
░░░░░░░░░░░░
▀██████████
░░░░░███░░░░
░░░░░███▄█░░░
░░██▌░░███░▀░░██▌
█░██░░███░░░██
█▀▀▀█▌░███░░█▀▀▀█▌
▄█▄░░░██▄███▄█▄░░▄██▄
▄███▄
░░░░▀██▄▀
.
REGIONAL
SPONSOR
███▀██▀███▀█▀▀▀▀██▀▀▀██
██░▀░██░█░███░▀██░███▄█
█▄███▄██▄████▄████▄▄▄██
██▀ ▀███▀▀░▀██▀▀▀██████
███▄███░▄▀██████▀█▀█▀▀█
████▀▀██▄▀█████▄█▀███▄█
███▄▄▄████████▄█▄▀█████
███▀▀▀████████████▄▀███
███▄░▄█▀▀▀██████▀▀▀▄███
███████▄██▄▌████▀▀█████
▀██▄█████▄█▄▄▄██▄████▀
▀▀██████████▄▄███▀▀
▀▀▀▀█▀▀▀▀
.
EUROPEAN
BETTING
PARTNER
Obim34
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 238
Merit: 202



View Profile
January 05, 2024, 01:04:33 AM
 #13

Hand work na better something wey go really help a lot for now wey be say things come hard small. The thing be say if everybody come go learn hand work e no go too make sense, who go pay who nah, e dey always better if the demand of the labor go pass the laborers so man fit see food put for him table.

Now comparing hand work and well paying job is one thing on its own, you can still be getting paid as a government employee and still be maintain your handwork somewhere, a need may arise which might give you much profits as your 3 months salary.

Considering on choosing one over the other i would go for being a government worker, getting a good payment with some benefits, less stress and enough chance to owning and growing a new business.
I know those who use hand work to feed their family barely have chances of their own free will, you get to deliver at the time which your customer needs the service if not will intrigue him into looking for someone else to do the job. 

Samlucky O
Full Member
***
Online Online

Activity: 280
Merit: 191


The great city of God 🔥


View Profile WWW
January 05, 2024, 03:18:01 AM
 #14

1, coming from a rich family: Today we come dey see am like say hard work come be poor man doings rich man pikin go reason say my family hold wetin I wan go learn work for abi that one no be stress for me.
Coming from a rich family no be excuse for no hustling or learning a skill. Wetting they cause that thing na the rich people always dey pamper there children say them no want make them suffer afteral them don make enough money so wetting be the need of too much hutle. And indirectly making the child to be lazy, forgetting say if there children no Start from from scratch say even the wealth wey dem dey keep for them, dem go miss use am because them never make #50k on there own before, and Naim they make many companies fold after the death of the owner. Because of mismanagement but apart from that I don see many rich kid wey no depend on there parent wealth but still make am for Life.

2, poor background:Yes poor background too fit hinder person from hand work for our country now wen things cost pass as we dey see am how poor person wan take cope with registration buying of materials for work and others.
Poor background no fit hinder person from success or learning a skill. Infact the poverty family wey you come from naim go give you the motivation to learn a skill. Sometimes no be every skill wey person dey spend money to learn. Like now as a guy, your friend dey into tyling or painting or of house. you fit take am out as guy man wey you be buy am bear, tell am say guy help me! we be friends abeg I wan learn your skill Make I take help my family, him go consider you. But before that you must keep of some kind characters, like
1. Pride : because some of us dey always like to show say we be friends and your friend no go fit send you message as a boss and you dey rub shoulder with person wey dey teach You work. So e better make you keep pride for house otherwise you no go fit meet up your target.
2. Humble and humility: for you to be successful in learning a skill be humble sothat the person wey dey teach you work gk bring out him mind to teach you wetting e dey Hide for you otherwise you fit stay 5 years without learning anything.
3. Dedication and smartness: smartness no be to shine eye, rather to bring your mind say you wan learn work and bring the very best in you. Many are called but few are chosen and if you no bring your mind you fit still no learn the work.
4. Creativity: above all Creativity Naim be most thing wey dey hinder most of us. Stop to dey copy rather try to do your own thing in another dimension and see if e dey worthy of people to like am. When I been learn piping work no be the way my oga teach me wey I been dey do I try to be creative and people come dey like my work even pass my oga work, no be say na pride o but with that creative when you don serve your boss come start on your own, na work go dey find you.


But wen we look am for another angle how you see am wen be say person learn work for like 6-7 years you graduate but no get the money to open ur own to be on your own? .
Sometimes no be every work wey you learn wey you go save money to start work. And morover a learning place is not a saving place rather a place to gather skill find the job you learn and when money don dey come you start up your  own business and start saving.

Jegileman
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 336
Merit: 170



View Profile
January 05, 2024, 10:03:49 AM
 #15

For me, I will go for the well paid government work. My reasons are very valid to me and there is nothing that will change my mind about it. Firstly, with my government work, I am guaranteed salary every month for the next 35 years with a percentage increase in the salary every 3 years. Secondly, I won’t need to spend the whole day at work, if it is a very serious job, I will be working from 8-5PM daily with some days off as holidays which are given to every government worker in every calendar year. Thirdly, I will have time to create a skill for myself that can be built from my savings I get from the government work, if I plan it well, it will be my source of income after I retire from the government work. And lastly, pension is guaranteed and I will be paid monthly for the rest of my live.

Makus
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 322
Merit: 215

Bitcoin!!


View Profile WWW
January 06, 2024, 06:03:22 AM
 #16

Normally I no go fit see work wey dey pay me well say I go leave am for hand work oo, because wattin some hand work no go fit pay in 6 month naim some of those men dey receive in just 1 month, and the funny part na be say, many of them just dey work for 2 weeks for 1 month. The gap for the comparison too much, nobody dey say hand work no good oo, you fit dey do hand work while you still they find all those kind of works. But e dey very rear say you go see person wey be NNPC staff say na hand work e dey fine.

The poor naim supposed to even see hand work as good opportunity sef because money no go fly from heaven come meet you, I remember when I been wan learn how to do recoiling of pumping machine, fan, blender generator coil etc. na oghoaja naim I do take get money to pay for installment fee.  So I see how poor background fit hinder any body to learn hand work.
odunybiz
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 630
Merit: 122


Epsiloan Protocol


View Profile
January 06, 2024, 08:31:11 PM
 #17

Nobody will see a good job that generates good money that will turn it down, the reason why most of us create job for ourselves is because their are no much job out there if you are looking for one and most times creating a job can be very financial stressful.  I think if I see a good goverment job with a good pay , I will go for it, save money to later establish a business that can bring more income for me . But the way the economy is going I think it is good for people to get skill .

Government job with good pay is good but nothing pays like good skills. Your skills can make you rich within limited time but most government workers live on loan for them to live an average like. For me, I will rather good for a skill that I know is needed in this recent time.

Y3shot
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 588
Merit: 164


Bitcoin👌 or nothing


View Profile
January 07, 2024, 10:13:56 AM
 #18

Nobody will see a good job that generates good money that will turn it down, the reason why most of us create job for ourselves is because their are no much job out there if you are looking for one and most times creating a job can be very financial stressful.  I think if I see a good goverment job with a good pay , I will go for it, save money to later establish a business that can bring more income for me . But the way the economy is going I think it is good for people to get skill .
Well said brother, na the way the country be nai make people dey attach an extra skill or handwork to support them because if you follow only profession this country fit go fuck you and dem don fuck plenty people and the worse part come be say these people them no even get any hand work or skill to support them for the real world because if to say dem get dem for depend on the system to actually survive and as many people dey see the economy dey go na come dey cause many people to go secure second option to take survive.
This no be time people need to depend on government job , depending on government job you fit end up been disappointed.  If you have skil you go get rest of mind because your skill will always generate money from you. As the year is going every year na so we dey get high lever of unemployment.  The government no dey really try , it will be better if young people coming up try their best to get a skill than waiting for the government to provide one.

AVE5
Member
**
Offline Offline

Activity: 168
Merit: 40

Eloncoin.org - Mars, here we come!


View Profile
January 07, 2024, 03:38:16 PM
 #19

Just as said well paid job would definitely be more embraced because a lot of persons would consider the time factors in learning to obtain the skills before creating a self reliance job and yet you would still need person's to hire you as an individual before you could make could of profitablities While the for the government, yes of course some criteria measures would also be considered because it should be believed that you can just give it up to the dumpheads who does not posseses the qualities that is required to deliver the government jobs.
In-between, skills or the handwork jobs has the balls of retirement to your hands that you may decide when to retire while the government jobs doesn't have you those privileges to decide.

ElonCoin.org    ElonCoin.org    ElonCoin.org     ElonCoin.org     ElonCoin.org    ElonCoin.org    ElonCoin.org
●          Mars, here we come!          ●
██ ████ ███ ██ ████ ███ ██   Join Discord   ██ ███ ████ ██ ███ ████ ██
Wiwo
Hero Member
*****
Offline Offline

Activity: 1050
Merit: 676


View Profile WWW
January 07, 2024, 04:39:21 PM
 #20

I been the think say las as you go relate this topic to cryptocurrency,  bitcoin or blockchain and its related developments as skills  this could have spiked up this discussion to meet current trends,  but nevertheless,  it is worth our discussion so let me drop my 2-cent on this matter.

Handwork is very necessary most especially when you are living in a country where the system does not work and is ruled by corruption and all manner of negative polity,  so having a government job in such a country is just like gambling you can lose it at any time and that the reason you have to work out modalities that will support you when that happens to the presence of comparison between government job vs skills,  is not anywhere comparable at all and for that skills should be a primary thing for all.

One of the popular skills to learn is to be able to be employable globally and work remotely,  and this requires contemporary skills.
Pages: [1] 2 3 »  All
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!