Original Topic: HODL is purely a mental challengeAuthor:1miau
Anybody wey don been hear of Bitcoin for don hear about HODL too . Because say people Sabi am well well (HODL) and na better way to take think of how you go take they get gain wella from Bitcoin for long time but they no go tell you how the things go long ooo.
HODL don de since
Bitcointalk post wey Dem do for 2013, where dey talk say make person no sell em Bitcoin even though say e no dey get gain na so so lose e lose but make e wait until e don rise again.
But e dey very very important say make we wait because some kind error from HODL na:
-To quickly sell
BTC con get small gain
-To quickly sell
BTC sake of say make you reduce the way wey you go take lose Incase say them reduce price
Another mistake na dangerous coin storage wey we dey do, for example now for file sharing platform, which dey increase risks wey go get am hacked. But for my post and for big Bitcoin HODLers dey assume am say our coins dey store well well, wey be say HODL dey also invite us say make we do, Neva say HODL go only need make we dey transfer our coins some times no be all the time wey go reduce our transfer or storage errors.
Make we put am for mine after we don't talk am: mistake wey de common pass for this HODL be say we de quickly sell our valuable BTC. So we ghat know and ready our sef say HODL na pure mental challenge.
Person wey good for HODL go fit resist temptation to take get small gains early and person wey good for HODL fit keep em Bitcoin.
Good HODLer go dey cool even when e get loss.
Best thing wey we fit do na to move our valuable Bitcoin go where we know say e go de hard to sell am.
And make we no store am for file-sharing network at all and for place like centralized exchange sake of say we no get our private key for that kind platform (no be you key, no be your coins).
After all ,na very important lesson to know say HODL na pure mental challenge. If you know say you wan do HODL wella you suppose know and you suppose pay attention to all this wey dey mention above.