From my own side I go talk say the two of them na actually prediction because even after you dn run analyses you no really dey sure of anything. I dn ask people wey dey into forex but some dey claim say e dey different. If you get idea about the two i go like know if anything really dey different for the two of them
My brother the two from one sense na actually same but the difference is that one is more hype to thinking that you can actually make a living out of it while the other one na purely luck business. For me the two of can be related to luck and stats, although many people believe say you fit use same stats follow up gambling but my brother I tell it's not easy and I would advise sef for anyone wey no get watin dey give am money to actually avoid this method because these two things need proper and strick income because you fit turn addict if you say you wan carry for head.
Na true you talk so, the both bah, if you look at them very well na still the same thing E dey talk about because the both carry luck for head, bet9ja na luck for ex exchange na luck too, you will gast put money for the both and if you get luck you will get pass waiting you put, the both just dey fear me because na something wey be luck things and if you are not a lucky person you will suffer ehn, but the worst one na bet9ja, bet9ja get one spirit wey be say even if you dey lose your money you no fit stop until your eyes open finish, I have seen many people that are doing forex exchange and if they don't have luck they will leave it for some time but bet9ja own na like spirit, because even money wey you go use chop you go wan use am bet
.