|
January 08, 2024, 06:16:03 AM |
|
Men how una see this new year na 2024 this year no carry pressure at all wen u see people dey shout happy new year for the new year e be like say everything go stew no be so thief go still thief, drunkard go still drink, mumu go still be mumu, but na the wise naim get the street but the wise too fit Jones why some wise fit grow to wisdom. Na your potential matters alot new year new year no mean say you go dey your house food come meet you every body go chop breakfast no be for the foolish, for the wise if you know use your head though you go chop but no be with joy some go chop am for cell some go chop am for prison some go chop like big men some too go beg chop so this year no too much pressure if you be inventor use your potential increase your investment if na this form wey me and you dey too put seriousness hustle dey pay put no be careless one.
The only thing wey fit make this year a new one as we call am na wen u change level wen you change things wen you do last year wen no bring joy even if e bring joy something fit give you more joy this year no be ginger nobody dey compete with you take your time if you get na them go talk if you no get na them go talk no take pressure, do your things your way. MY ADVICE.
|