Almost every morning when I go wake up I go de see this charge of 6.9 naira and no be just for morning oh, sometimes I go just see some alert when be say na small money and I no de too reason am but if you look at our frequent this money de comot, e fit amount to something big oh.
I dey use more than one bank and I no dey receive dis kind debit of N6.9 wey you dey talk. I no say banks dey very wicked when it comes to charges sometimes but when you compare am to the bitcoin transaction fees, you go still prefer this small small charges daily because even after one month of the charges, e no go still reach 1K wey dem go don charge you in total. But with bitcoin transaction as fees don rise, even though $50 you wan transfer and na $5 dem wan charge you wey small be dat as the market take be now, e no go better make bank charge you 1K to transact 500K out of your bank sef?
Banks dey charge unnecessarily o, but their rate still good pass bitcoin transaction fees own for now using our traditional bank.
Lol,,, nai be say you never jam bank fee hike.
Anyway I no go like talk too much but just check this phone way I go drop below.
As you can see, na first bank I dey use and this nah the kind of charge dem dey collect from me on every transaction way I dey do.
Just like yesterday nai me and my brother dey talk this matter about this high transaction fees from bank, although, no be every bank fit dey charge that kind of charge.
The worst part of the matter be say after all this fees, them go still collect watin no good comot from your account,,, my quest be say if them dey collect all this money from each transactions, then why e be say them still dey collect those big money ones in a month from each person account?