What if our school just ends In ss3 after which every one learns a particular relevant trade without going to the university? Wouldn't it give our youth the ability to specialize more in their chosen field thereby making them more productive?
Make we first forget the skul matter here first, make I just give you this simple example.
person wey be 40years old you no go compare the exposure wey em go get with the person wey be 20years, because you go dey always expect am to produce good quality over person wey be 20years because you know sey em for don learn plenty things in life.
Someone in university dey far exposure than person wey stop for ss3, if skul stop for ss3 how we wan take produce professional engineers, medical doctors, and a lot of professionals courses wey involve human life??
What if we don't need to hustle too much? We just get enough money that can feed ourselves and family and everyone just lives a simple lifestyle.
Hustling make life more easier for us o, because if all of us gather money wey we no too work for we no go dey see each other with respect again and even common sense no go dey. remember money is the root of all evil, because as u dey feel sey you get the plenty money na so I go dey feel am too and respect no go dey but by the time wey we work hard to get am we go learn how to live in a simple life.
What if we have no leaders? We just do our thing and live our lives the way we want o.
Just imagine am sey we no get leaders in this forum how e think sey e go be? All of us go dey without no direction.
You can only live the way you want when you get a leader because once you dey go wrong part a leader go tell u or advice you d right tin u go do.
We dey complain of bad leadership for Naija just imagine am sey we no con get leader kpata kpata you know sey e no go better for us.
What if we don't have any set out rule? We just live our lives according to our believe system?
Assuming sey we don't have any set of rules in this forum, do u know numbers of plagiarism and spamming post we go dey see everyday?
In every society dey get rules wey guide am and once u obey am you go enjoy ur life there. If u sey u go live according to your believe system you go end up living a miserable life o.
We love bitcoin because of it decentralized nature right? What about living a life that is void of a third party interference?
This doesn't make sense you can't compare bitcoin with human life.
How u wan take live without interacting with people na you go inject urself for hospital? We all need each other service in life.