My people l greet oo this thing keep ringing in my heart despite not being a crypto matter, why is it that little things are always difficult to handle most time it curse more pain and hardship compare when handling big thing.
You don talk am already, no be crypto matter, dis discussion no sopos dy here in the first place but anyhow make I respond to ur question.
Just as you call am little tin, nai make e dy normal hard us because in the first place we see am as nothing, we just underate am, see make I tell you, anything you underate go give you more troubles than even the big one wey you go prepare for.
Just as our country be so, the minor jobs like ogwaja nai hard pass and na him still pay less pass base on say na Nigeria in general no see am as big work, but you see all those big big jobs, just go there office and observe, nothing dem dy even do there, na less stress and na dem recieve better money pass, so the conclusion is that small tins normally sabi stress person, because only how the money small self, e dy discouraging to put in too much effort.