For this our 9ja the way things dy go Due to recession
No work
Plenty children
High cost of food
The hunger don make thief's Dy even thief anything for the country.
Mama dem Dy complain how thieves Dy enter their farm Dy thief cassava, three leave yam, the worst na plaintain, them no Dy cut the stem but the fruit Dy miss. When u come in the morning your plantain go still Dy where e Dy stand but no fruit.Naso people Dy enter betting shop Dy bet game on credit come drop their phone as collateral.
The one wey shock me pass na police people follow this new trend o, u go see police man on duty uniform Dy inside betting hall.
The one way fear me pass, u go see person go wan use #100 win 1 billion as in the greed too much.
Me I don Dy think of to open bet9ja shop e b like na their business Dy flurish now.
No set of people get hope pass them. U go see situation where person go don spend #100 reach #100,000 but e still get hope say one day e go recover all e lost wen e go win.
The spirit wey Dy that thing, if u try win na to carry Ur money go solve other problem. But u go see some people go still use the money play game again come return house with empty hand.
Omo as things dey for the country, baba you gats do any legit work to earn a living, everyday thing's for we country dey cost, so if na betting way boys go use money to use sustain, then no problem dey there, as long as say e day within the ambit of the law.
One thing with betting be say, the game way go give you plenty money, u no go know, so na to continuously dey knack the game's dey go till your luck shine, so no see am say people dey but all their hope for gambling but see am as normal hustling.