|
February 01, 2024, 10:31:28 AM |
|
Oga I know say you really dy new here, that's why you need to do ur own research first or person wey bring you come this forum sopos tell you one or two concerning what to post and what not to post, abi any musician dy for this forum wey I no know about? As a newbie try to read more expecially the rules, so that you no go fall any law, abeg na for ur own good, no feel say I dy attack you, because I know say you no know, but read the rules of the forum first, cos e go help you a lot, and if you wan grow fast for the forum na to do more reading now concerning Bitcoin related topics, so that you go learn fast and you go also get wetin to talk self for another board outside this our local board because wetin I don observe since I dy here is that some people no get anything to post about outside naija board, just help urself and may God bless you.
|