My pipo as we all know say the matter concerning nde rate of how Dollar take dey strengthen over de Naira, Na something wey get negative and positive impacts for fellow citizens. Some of us get friends, brother, pipo around us wey dis thing dey affect dem either good or bad. I get friends wey dey earn $200,000 weekly and because Naira dey week de guy dey acquire better properties and other assets and him happy as the Naira dey week because him earnings get big value and I also get friends wey dey complain negatively about de situation.
As dollar dey go up, people wey dey earn in dollar, their money to dey increase, so e get small advantage for them, but people wey dey do government work na those people e dey affect badly, because as dollar dey go up, price of things too dey go up, and their salary dey the same, so na people like that go hear am for body pass.
But even people wey dey earn in dollar, no be say dem go fit acquire plenty things just d way u dey reason am ooo. D way dollar dey go up, price of things dey multiply also, Wetin you go buy with 1000 Naira when dollar still dey low, you go need hold like 5000 naira if you wan buy am now, most especially things wey dem dey import come dis country. Try enter were them dey sell cars make you see d way dem put money for cars now. So no be say people wey dey earn in dollar go fit dey accumulate plenty properties, but those people better pass people wey dey earn in Naira.
Earning in dollars just make the situation abit bearable when compare to the salary earners. You earn in dollar, trade it to naira to buy expensive things. After trading it for Nara, the money sounds big but doesn't worth it. I wish the economy is being stabilized for everyone to enjoy.