See eh, during the bull run, no be all coin dy rise oo, most of this alt and shit coin wey dy in your possession fit frustrate the haven day light out of you during the bull run, so to me if you wan dy sure say you self go benefit from this bull run, I suggest you accumulate like 95% more of Bitcoin, than park alt and shit coin wey fit disappoint you during the bull run, abeg newbies like me make ona follow who know road so that ona no go lost.
Dis na better advise for all newbies and if dey can listen to dis advise, dem no go dey disappointed when bull run go come. Dos people wey dey mostly make am through dos alt coins and shit coins na investors wey don dey the space for long. Dos ones dey do research and don already know coins wey go give dem better profit for bull run. Some of their analysis no dey go well all but na few dem still dey miss out on. If you no be dat kind investor wey no get prior knowledge for cryptocurrency before, make you no try invest for alt coins anyhow. E better to invest in mostly bitcoin to see say your profit grow small dan putting it for altcoin wey go make you lose everything. Make selfish interest no push you go do anyhow and lose everything.