My country people, ona good morning, wetin I wan talk now na for mostly to our newbies because I believe say most of ona wey be veterans for this forum know this tin, but because of say newbies dy sign up everyday, I just say make I update Dem.
The issue of depending on a single income for this current economy na suicide oo, because as we dy this country, the way price of everything dy add up everyday, I just dy imagine how people wey dy depend on a single income dy use cope, talkless of those wey no even get job, because e no dy funny again at all, just imagine if you get like 3 to 4 tins wey dy give you money, no matter how things tough, e no go fit overwhelm you, because your financial ground dy strong, our newbies, make ona try to dy creative enough to double ona hustle oo, because right now e no easy for those with a single income.
Omo I don reason the matter tire, I no fit think again cos the more i dey think about the matter, thr more my head dey pain me.
People I dey pity pass na people wey no get job at all, I come dey reason how them dey take survive for this country wey things don spoil like this. Today I say make I go fill my gas, omo as I go, them tell me say 1kg of gas na 1500
I no know when I shout Jesus. When gas enter 1k I dey para dey shout for them, but just imagine now, so how people wey no get work wan take dey survive for this kyn tough economy, the poor dey complain, even the rich sef dey complain.
The matter just tire me