Where you right stop na wey somewhere else right begins. In defending our right let's be caution. Speaking your mind or protesting against bad governance is a right of every citizens but you must do it peacefully with a good reason. Just like the endsar protest was a good initiative but lack coordination and it became violence, such demonstration is not a good way to demand for justice. We know government are evil and they control the security so you must use your head when making demands, do it rightly, no one is stopping you from demanding your right.
I understand wetin you talk oh but when you talk about protesting in peace for this country I no think say e go bring anything positive becos to the government them go think say we no serious and the amount at which we the citizens dey unserious about things for the country even for the social media self go give them that impression say we no ready for wetin we want. I think na too much force we need to take wetin be our own which is our right. EndSars na example as you talk but the support no too dey to strengthen the motion, e for work out oh but when government see wetin them go lose nai the mass killings come into play. Wetin I want make you get be say anything wey be peaceful protest e no dey ever move our government to do something wey go favor us but if we get like international help I believe say we go freely do am and get our goal becos the government dey fear those away piple.
Peaceful protest wey I talk here be say make dem no destroy properties or stop people wey no gree join from their daily work. E get as dem go coordinate the protest wey de international human rights to back am up, no to dey destroy government properties to register your displeasure no international body go back such protest, and mk face dey the protest you no go demand weytin government need pass through constitution to achieve am, demand for immediate solutions like improvements in our health centres, increase in eduction budget to 20%. Subsidy removal and price control, urgent rehabilitation of the four refineries for job creations and many sensible things. Government will respond quickly to such things, and let the leaders of the protest be honest people not thiefs like the Endsar coordinators, till date some funds people donated to the protest are missing, such an unfortunate act.