Yeah I think it's a good idea to enlighten others on how this jobs really works and I don't blame them to calling you a scammer because in this Nigeria, once you start using a laptop in the late midnights, my dear you're becoming a scammer
, it's just the mentality of thousands since we know majority of the fraudsters do their works in the late midnight, It will be very hard to justify yourself. I was also frustrated sometimes but you should show it from your behaviour, dressing and character that you're different
, I think that's the only way to convince them
I gree with you and na the trajectory be that. When you look back at those days when scamming start for Nigeria, you and I go gree say plenty people wey dey do late-night with their laptops dey actually scam people. But as time dey go, people don come sabi say dey get other options to make money and e no be say them go dey scam. So many people don do other works like the OP mention above, like affiliate marketing and even other jobs wey you fit do for companies wey dey outside the country. And you go dey earn your legitimate money from them.
And because of the time zone differences for our work hours with them, you no go get choice pass to stay up late for night. When you do am, e go they easier for you to meet up with your work schedules. And na why plenty people dey do late-night jobs now. Apart from that, for person like me wey dey used to writing, the fact be say I dey write for my laptops and mobile phones, and the time wey I dey enjoy to write na for late at night because na that time I get sanity and disturbance no they too dey for those periods of time. So e no even necessarily mean say I get job to deliver for late-night, but I don sabi say plenty creative jobs dey happen for those hours of time.
So if I wan enjoy writing, I dey usually wait until late at night before I do am. And e no necessarily mean say I be scammer. So we just need to change our psyche at the end of the day. And we need to make plenty young people, especially those wey dey grow, understand the basics of why people dey work even late at night, and make e no be say dem go dey attach am to scamming. So that we fit all change our perception for viewing things, and we fit be better nation as a whole.
Very important point to mention be say the way we dey think get key role to play for our lives. So the moment people start to think negatively, e go affect dem negatively. But the moment we start to think positively, e go better for us as society, and people go get knowledge of how things dey operate for the outside world, and no be only for Nigeria.