Bitcoin Forum
May 02, 2024, 11:49:23 AM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1]
  Print  
Author Topic: Wetin be Address Poisoning Scams?  (Read 41 times)
Chilwell (OP)
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 560
Merit: 408


The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID


View Profile WWW
March 25, 2024, 06:35:56 PM
Merited by Pmalek (2), 1miau (2), Nheer (2), EL MOHA (2), Humblevirus (2)
 #1

Original Topic: What are Address Poisoning Scams?
Author: Pmalek


Many of una for don hear and some of una even don experience the address poisoning scams. Na new type of fraud   wey don dey popular for 30-40 days now. E dey appear for blockchains with cheap transaction fee, e go allow scammers to take send many low cost transactions. I never read of any case where this thing affect Bitcoin network, but e still good to know about am just Incase say you experience am for future for your BTC wallet. Hardware wallet manufacturers like Ledger don say scammers dey target their users too. So stay alert.   

Wetin be Address Poisoning, and how e take dey work?

The scam dey work when Dem send potential victims small (near zero) crypto transactions. you go see new entry for your transaction history when e happen. The address wey go send the coins/token go resemble your own. The first and last two or four characters go dey identical.

The scammers go wan make you think say na your own address. So you go con copy am from your transaction history when you wan send money to yourself or another person . For this kind matter now the money go enter the scammer account no be your own. 

For which Blockchains wey Address Poisoning dey common pass? 

People wey been dey use this blockchain network don already experience this address poisoning for one way or the other:

1.   Tron
2.   Binance Smart Chain
3.   Polygon
4.   Ethereum
5.   Maybe others

Safety measures and Wetin to do next

If you be victim of address poisoning, dey no get any reason say make you fear. Nobody dey target you personally. Fraudsters to choke eyes for those people wey dey do transactions well well wey dey move better amount of money.

Your coins no dey at risk . Your private keys/seeds never leak, and nobody fit dey control your own address, no matter the transactions history. Dey no get any protection against address poisoning per se, because you no fit stop person make e no send you crypto. E go dey safe say make you use those coins too. 

E get somethings wey you go need do to always dey safe when you dey send or receive crypto:


•   No ever copy address from your wallet transaction history.
•   No ever copy address from blockchain explorer.
•   Dey always generate or copy addresses from your wallet's receive or  addresses tab.
•   When you dey send coins go another place, copy the address from the source or destination.
•   If you dey transfer crypto  to different person, tell the other person say make e send the correct address.
•   Verify the full address, no be only the first and the last characters.
•   If you dey use hardware wallet ,ensure say the for your software de match the one wey de show for your device screen.  
•   Dey ready to double and triple check if you need am because Dem no fit reverse cryptocurrency transaction. So once your money don go e don go forever be that. E better to spend extra minutes dey check  wetin you dey do than to regret say you no do am.


For more information on address poisoning scams, make you take look at this sources:

Beware Of Address Poisoning Scams
Address Poisoning Attack, A Continuing Threat
SlowMist: Another Airdrop Scam, but with a twist

R


▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄
████████████████
▀▀▀▀█████▀▀▀█████
████████▌███▐████
▄▄▄▄█████▄▄▄█████
████████████████
▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀
LLBIT|
4,000+ GAMES
███████████████████
██████████▀▄▀▀▀████
████████▀▄▀██░░░███
██████▀▄███▄▀█▄▄▄██
███▀▀▀▀▀▀█▀▀▀▀▀▀███
██░░░░░░░░█░░░░░░██
██▄░░░░░░░█░░░░░▄██
███▄░░░░▄█▄▄▄▄▄████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
█████████
▀████████
░░▀██████
░░░░▀████
░░░░░░███
▄░░░░░███
▀█▄▄▄████
░░▀▀█████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀
█████████
░░░▀▀████
██▄▄▀░███
█░░█▄░░██
░████▀▀██
█░░█▀░░██
██▀▀▄░███
░░░▄▄████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀
|
██░░░░░░░░░░░░░░░░░░░░░░██
▀█▄░▄▄░░░░░░░░░░░░▄▄░▄█▀
▄▄███░░░░░░░░░░░░░░███▄▄
▀░▀▄▀▄░░░░░▄▄░░░░░▄▀▄▀░▀
▄▄▄▄▄▀▀▄▄▀▀▄▄▄▄▄
█░▄▄▄██████▄▄▄░█
█░▀▀████████▀▀░█
█░█▀▄▄▄▄▄▄▄▄██░█
█░█▀████████░█
█░█░██████░█
▀▄▀▄███▀▄▀
▄▀▄
▀▄▄▄▄▀▄▀▄
██▀░░░░░░░░▀██
||.
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
░▀▄░▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄░▄▀
███▀▄▀█████████████████▀▄▀
█████▀▄░▄▄▄▄▄███░▄▄▄▄▄▄▀
███████▀▄▀██████░█▄▄▄▄▄▄▄▄
█████████▀▄▄░███▄▄▄▄▄▄░▄▀
███████████░███████▀▄▀
███████████░██▀▄▄▄▄▀
███████████░▀▄▀
████████████▄▀
███████████
▄▄███████▄▄
▄████▀▀▀▀▀▀▀████▄
▄███▀▄▄███████▄▄▀███▄
▄██▀▄█▀▀▀█████▀▀▀█▄▀██▄
▄██▄██████▀████░███▄██▄
███░████████▀██░████░███
███░████░█▄████▀░████░███
███░████░███▄████████░███
▀██▄▀███░█████▄█████▀▄██▀
▀██▄▀█▄▄▄██████▄██▀▄██▀
▀███▄▀▀███████▀▀▄███▀
▀████▄▄▄▄▄▄▄████▀
▀▀███████▀▀
OFFICIAL PARTNERSHIP
FAZE CLAN
SSC NAPOLI
|
Pages: [1]
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!