Bro this topic na subject questions, women and men matter no dey go straight forward. Women dey agree for men base on different things and some factors don dey established like money, popularity, physique and strength. So it depends on the category wey the woman find attractive in the man and likewise also the woman side. Although the economy never still help matter these days as money scarce, many women don enter street.
My dear, you don talk am finish, women dey go where dem fit benefit, if not dem no dey reason person matter, so I no think if women dey cheap and if dem no love u too, and as this economic be like this, everybody dey find wer e go better for them, so I no too blame some women wey dey for street and no body dey to help dem so pressure dey make person do some kind things and now na women dey benefit pass because men go just hustle money still dey give women and dem go dey complain say na women dey cause am. So make we live women hand, concentrate on ourselves because na we dey spoil women.