Op do you really understand weti you dey talk at all. Nigerian digital economy e don help people to have jobs. Na your mouth I dey first hear dis kind things. Where di job dem dey wey we no dey hear am. My man Nigeria still dey far from the uses digital economy. If Nigeria understand digital economy dem for no allow Binance leave di country. Nigerian digital economy is stagnant and not even moving to anywhere instead they are looking for whom to blame. Look at the eNaira, how many Nigerians dey use that wallet or service? Nigeria Technology (ICT) e dey very weak and dat is why we even have slow network with high cost of data. Technology in Nigeria never contribute to the growth of the country economy. Nigerian economy is just dollarcentric with crude oil and not anything from the tech department or ministry.
Me I don't know where you go get you information. Di problem is even caused by di government. Dem no dey ready to develop the Technology ICT ministry which na di Ministry Of Science and Technology. And di only thing dey know na to suffer di citizens with bogus registration of line, collecting high registration fee from any digital job done by them such, NIN, Sim card, Mobile Data to browse and and others. Oboy no talk dis thing for another place oh. Nigerian digital economy e no dey grow anywhere.
But even at that when you look at the stats and compare with other African nations at large, I believe say Nigeria fit dey do well although am speaking on behalf of this particular thought base on the private sector side but in a general and public sector as the government don supposed development am reach they are doing absolutely nothing rather even making things hard.