E don tey wey dem introduce enaira for Nigeria, but as we dey look am now, why enaira no dey work?
Why Nigerians No Dey Use eNaira?
No misunderstand, Nigerians Na crypto enthusiasts meaning say them like crypto well well.
Even though Central Bank of Nigeria bin ban crypto activities for banking sector some time ago, but dem don lift the ban. One crypto platform talk say over 33.4 million Nigerians dey trade or hold crypto assets. The question be say
Why country wey dey love crypto well well just decide to abandon their own digital currency?
According to research I make the following factors follow make E-naira for Nigeria unsuccessfull
1. When CBN ban Crypto
Wen Central Bank of Nigeria (CBN) stop banks from dey allow payments wey get to do with crypto for February 2021, Nigerian crypto users see am as attack against dem.
Later wey dem bring eNaira, e be like say dem dey compete with crypto, so e make crypto lovers feel say dem no suppose dey use am; E be like say na psychology matter for my mind.
If CBN bin involve these crypto people for the eNaira plan, e for fit make crypto popular pass and plenty Nigerians for don dey use am.
2. CBN no want Partnership
For dem to do eNaira on their own dey bad idea because CBN na regulator, e no be institution wey dey face consumers.
3. Internet Access
The requirement for wallet to use smartphone and internet dey hard, but think about the people wey you dey try send money to; dem fit dey very poor, without a good smart phone or even some villages wey network no dey reach
4. We no trust government again
Since then get the mind bind crypto and related activities investors wey supposed invest for the E-naira no come trust the credibility of this government as some see am say the politicians no want make young people get money pass them through crypto. Because even that time Davido been announce say em go buy Bitcoin.
My people for this matter abeg make we add our opinions.
My brother nothing come out for our E- naira, just imagine government wey dy instigate us to use the E naira, nai dy fight crypto and binance wey make them later leave the Nigerian market, because to me, that e naira of a thing, na just means wey Dem wan use chop money, so once them achieve their goal, nothing concern them again.
Lastly, na only people wey no get sense go put their hard earned money for E naira because government fit just wake up one morning come create a policy toward that e naira wey for you to get ur money back, e go become serious war, so my brother, na only person wey no wise naira go see e naira as something.