I see no problem there, Nigerians writing with English language, although I know it's a local board.
Nobody talk say problem Dey now, and all of us don conclude say na both English and pigin we go Dey use post, but Wetin the OP Dey try talk be say make some topics tittle be pigin, if you check the front page you go see say na English dem use write all the topics, if you enter dis local board, you go think say na general board until u come check the name. But if some posts tittle na pigin, anybody wey open the local board go know say dis one na naija local board.
I know say some people prefer to use English to post, but abeg people wey Dey use pigin post, if Dey wan create post tittle make dem try Dey use pigin, some post Dey wey na pigin e go be, but if d person wan write post tittle na English him go use, make we Dey try use pigin also for tittle.