Bitcoin Forum
April 30, 2024, 10:18:54 AM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1]
  Print  
Author Topic: I Say Make I remind Una About this Matter  (Read 98 times)
Davidvictorson (OP)
Hero Member
*****
Offline Offline

Activity: 966
Merit: 832


Livecasino.io


View Profile
April 13, 2024, 02:59:10 PM
Last edit: April 13, 2024, 05:51:17 PM by Davidvictorson
Merited by RockBell (2), Hatchy (1)
 #1

My Naija pipo, I dey greet una specially.
Abeg eh, I say make I bring this very importanta reminder give una. This one na based on wetin happen this week wey one of our country pipo here matter enter reputation board. Dem oyibo talk say him use AI dey write bla bla bla before him to fit defend himself dem don knack am red tag. As e be now sef, the guy account don spoil. With the way wey tins hard for the country, e go dey extremely difficult for person especially young Nigerian to dey without income assuming say the guy still dey find job and just dey use this one take hold body.

Wetin I wan remind una be say

  • make una no dey in a hurry to click post when una write. Read and re-read.
  • Learn cite wetin you copy wey nor be your own.
  • If you nor dey sure make you use plagiarism checker websites take check wetin you write.
  • Abeg if you use AI take assist you, nor shame, write am say na AI you use. If you nor write am and dem catch you, na there wahala dey.
  • I sabi say some of us na professors base on say we get A1 for English for school so we dey like to use big big English take write and we dey write better English pass the colonizers wey be say even if you run am through those AI checker, e go tell you say na AI write am nor be human. Because how you go take explain give them say na you write am. Do the check and do the needful.


Make e nor be like say I just dey talk without solution, I don write some AI and Plaigrism checker wey una fit dey use to make person nor enter wahala.

Plagiarism Checker
- https://1text.com/
- https://text.ru/


AI websites checker
- https://copyleaks.com/
- https://writer.com/ai-content-detector/
- https://x.writefull.com/gpt-detector
- https://contentatscale.ai/ai-content-detector/
- https://gptzero.me/
- https://contentdetector.ai/
- https://hivemoderation.com/ai-generated-content-detection
- https://paraphrasingtool.ai/writing/ai-content-detector/
- https://detector.dng.ai/
- https://quillbot.com/ai-content-detector

*Most of these AI checker website still dey run plagiarism checker too.
*if you dey find the thread about the user see am here - https://bitcointalk.org/index.php?topic=5456516.480

I wish all of una well.
Una doh

██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
... LIVECASINO.io    Play Live Games with up to 20% cashback!...██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
1714472334
Hero Member
*
Offline Offline

Posts: 1714472334

View Profile Personal Message (Offline)

Ignore
1714472334
Reply with quote  #2

1714472334
Report to moderator
1714472334
Hero Member
*
Offline Offline

Posts: 1714472334

View Profile Personal Message (Offline)

Ignore
1714472334
Reply with quote  #2

1714472334
Report to moderator
1714472334
Hero Member
*
Offline Offline

Posts: 1714472334

View Profile Personal Message (Offline)

Ignore
1714472334
Reply with quote  #2

1714472334
Report to moderator
According to NIST and ECRYPT II, the cryptographic algorithms used in Bitcoin are expected to be strong until at least 2030. (After that, it will not be too difficult to transition to different algorithms.)
Advertised sites are not endorsed by the Bitcoin Forum. They may be unsafe, untrustworthy, or illegal in your jurisdiction.
Hatchy
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 392
Merit: 460


The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID


View Profile
April 13, 2024, 05:12:57 PM
 #2

Well, my brother you do well for this correct information wey you bring come. I just hope say our people Dem go dey suffery do anything wey Dem dey do for this forum. Small time wey I Dom spend for this place don let me know say, these oyibo people Dem no get joy and if you match Dem tail, Dem go do anything to make sure say you collect. Sha una don see the wey Dem tag dat our brother because say e use ai take make post.

 And e get one place again wey Dem still talk say person fit use Ai take correct him English that wan na if e no sabi English well. But my people make una wise. you fit fall for wahala Dem go denial am. so make una try dey use una own English take post at least d wan wey Dem no understand Dem go quote you then you go explain. Ai self no go help you go far because for here, ones Dem don monitor your posting style and Dem notice change Dem must talk. So try use Una own English take dey post.
Avoid copy copy work if you no know answer abeg pass no go dey try do smart kid con copy from somewhere and you forget put link. Dem no go hear abeg o.

███████████████████████████████▀▀▀▀
███████████████████████████████
█████████▀▀▀▀▀█▀█▀▀▀▀▀█████████
███▄▀▀▀   ▄▄▄▄   ▄▄▄▄   ▀▀▀▄███
███████▀▀▀████▌ ▐████▀▀▀███████
█████▀███▀█▀██▌ ▐██▀█▀███▀█████
███████▀▄▀▄███▌ ▐███▄▀▄▀███████
█████▄██▄██▄██   ██▄██▄██▄█████
███████▄▄▄████   ████▄▄▄███████
██████████▀▀▀▀   ▀▀▀▀██████████
██████████▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄██████████
███████████████████████████████
███████████████████████████████▄▄▄▄
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
.
TRUST DICE
.
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
█▀▀▀











█▄▄▄
#1 RATED CRYPTO
CASINO IN THE WORLD
██ ██ ██ ██ █Trustpilot
▀▀▀█











▄▄▄█
▄█████████████████████████████
██████████████████▀▀█████▀▀████
█████████████████▀█████████▀███
██████████████████████████████
███████████████████████████▄███
█████████████████████████▄▄████
███████████████████████████████
█████████████░░░███████████████
███████████░░░█████████████████
█████████░░████████████████████
█████░░░██████████████████████
███░░█████████████████████████
▀░░░█████████████████████████▀
█▀▀▀











█▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
Jegileman
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 322
Merit: 168



View Profile
April 13, 2024, 06:14:11 PM
 #3

  • If you nor dey sure make you use plagiarism checker websites take check wetin you write.

Dis dey very necessary because we no go fit tell if post don dey plagirase already even though na we write am ourself. In most cases, to comment for post no dey carry any thing related to plagiarism. Most time na post wey we wan create by ourself and we want make e make sense to the reader dey cause am. E better make you write am d way you sabi, anywhere correction dey, you go dey corrected for the comment section.

Quote
  • I sabi say some of us na professors base on say we get A1 for English for school so we dey like to use big big English take write and we dey write better English pass the colonizers wey be say even if you run am through those AI checker, e go tell you say na AI write am nor be human. Because how you go take explain give them say na you write am. Do the check and do the needful.

For all the times wey I don see the way that plagiarism checker dey work, if your words na straight from your head without the knowledge from other sources on the internet, dem no get way that tin go say na plagiarism. E dey really fit differentiate between human and computer. The best thing still remain make we try use plagiarism checker if we dey doubt wetin we write wey for cause am to be AI generated content.

Agbamoni
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 308
Merit: 281



View Profile
April 13, 2024, 08:30:09 PM
 #4

Well, my brother you do well for this correct information wey you bring come. I just hope say our people Dem go dey suffery do anything wey Dem dey do for this forum. Small time wey I Dom spend for this place don let me know say, these oyibo people Dem no get joy and if you match Dem tail, Dem go do anything to make sure say you collect. Sha una don see the wey Dem tag dat our brother because say e use ai take make post.

 And e get one place again wey Dem still talk say person fit use Ai take correct him English that wan na if e no sabi English well. But my people make una wise. you fit fall for wahala Dem go denial am. so make una try dey use una own English take post at least d wan wey Dem no understand Dem go quote you then you go explain. Ai self no go help you go far because for here, ones Dem don monitor your posting style and Dem notice change Dem must talk. So try use Una own English take dey post.
Avoid copy copy work if you no know answer abeg pass no go dey try do smart kid con copy from somewhere and you forget put link. Dem no go hear abeg o.
Weting i understand na say you no need to match their tail before them step on you. N athem they carry their leg they go find places where we done drop shit so that they go attack us. I fit remember when one of them say him done dey research on our pidgin language and this word "Wen and Wetin" na em many naija people they use say em find out say na people alt be that wey they use am. I come they wonder whether this people wan teach us our own pidgin language eh. Just imagine the extend of going to study our pidgin language you would know how obsessed this people dey. Envynes and jealousy na wetin full the forum so make we just they careful.

.
Duelbits
DUELBITS
FANTASY
SPORTS
████▄▄█████▄▄
░▄████
███████████▄
▐███
███████████████▄
███
████████████████
███
████████████████▌
███
██████████████████
████████████████▀▀▀
███████████████▌
███████████████▌
████████████████
████████████████
████████████████
████▀▀███████▀▀
.
▬▬
VS
▬▬
████▄▄▄█████▄▄▄
░▄████████████████▄
▐██████████████████▄
████████████████████
████████████████████▌
█████████████████████
███████████████████
███████████████▌
███████████████▌
████████████████
████████████████
████████████████
████▀▀███████▀▀
///  PLAY FOR FREE  ///
WIN FOR REAL
█████
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
█████
██████████████████████████████████████████████████████
.
PLAY NOW
.
██████████████████████████████████████████████████████
█████
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
█████
Rruchi man
Legendary
*
Offline Offline

Activity: 1274
Merit: 1083


Bitcoin Casino Est. 2013


View Profile
April 13, 2024, 09:50:10 PM
Merited by Davidvictorson (2)
 #5

  • If you nor dey sure make you use plagiarism checker websites take check wetin you write.
Some people dey actually know when dem dey plagiarize, but because them just wan do smart and feel say dem fit cheat the system, they go ahead to copy and paste, or even use AI to write thinking they will not be detected. So nor be like say these people nor dey know when dem dey do am, na intentional act to some, they nor need any plagiarsm or AI checker website to know.

Thank you for sharing this though, it will be helpful to people who need it.


███▄▀██▄▄
░░▄████▄▀████ ▄▄▄
░░████▄▄▄▄░░█▀▀
███ ██████▄▄▀█▌
░▄░░███▀████
░▐█░░███░██▄▄
░░▄▀░████▄▄▄▀█
░█░▄███▀████ ▐█
▀▄▄███▀▄██▄
░░▄██▌░░██▀
░▐█▀████ ▀██
░░█▌██████ ▀▀██▄
░░▀███
▄▄██▀▄███
▄▄▄████▀▄████▄░░
▀▀█░░▄▄▄▄████░░
▐█▀▄▄█████████
████▀███░░▄░
▄▄██░███░░█▌░
█▀▄▄▄████░▀▄░░
█▌████▀███▄░█░
▄██▄▀███▄▄▀
▀██░░▐██▄░░
██▀████▀█▌░
▄██▀▀██████▐█░░
███▀░░
Cryptomultiplier
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 756
Merit: 180


Eloncoin.org - Mars, here we come!


View Profile WWW
April 13, 2024, 10:24:36 PM
 #6

My Naija pipo, I dey greet una specially.
Abeg eh, I say make I bring this very importanta reminder give una. This one na based on wetin happen this week wey one of our country pipo here matter enter reputation board. Dem oyibo talk say him use AI dey write bla bla bla before him to fit defend himself dem don knack am red tag. As e be now sef, the guy account don spoil. With the way wey tins hard for the country, e go dey extremely difficult for person especially young Nigerian to dey without income assuming say the guy still dey find job and just dey use this one take hold body.

Wetin I wan remind una be say

  • make una no dey in a hurry to click post when una write. Read and re-read.
  • Learn cite wetin you copy wey nor be your own.
  • If you nor dey sure make you use plagiarism checker websites take check wetin you write.
  • Abeg if you use AI take assist you, nor shame, write am say na AI you use. If you nor write am and dem catch you, na there wahala dey.
  • I sabi say some of us na professors base on say we get A1 for English for school so we dey like to use big big English take write and we dey write better English pass the colonizers wey be say even if you run am through those AI checker, e go tell you say na AI write am nor be human. Because how you go take explain give them say na you write am. Do the check and do the needful.


Make e nor be like say I just dey talk without solution, I don write some AI and Plaigrism checker wey una fit dey use to make person nor enter wahala.

Plagiarism Checker
- https://1text.com/
- https://text.ru/


AI websites checker
- https://copyleaks.com/
- https://writer.com/ai-content-detector/
- https://x.writefull.com/gpt-detector
- https://contentatscale.ai/ai-content-detector/
- https://gptzero.me/
- https://contentdetector.ai/
- https://hivemoderation.com/ai-generated-content-detection
- https://paraphrasingtool.ai/writing/ai-content-detector/
- https://detector.dng.ai/
- https://quillbot.com/ai-content-detector

*Most of these AI checker website still dey run plagiarism checker too.
*if you dey find the thread about the user see am here - https://bitcointalk.org/index.php?topic=5456516.480

I wish all of una well.
Una doh

Well-done for this reminder o, na better thing you do to remind us this one wey fit don be old news for many of us oldies. Na this kind of post I they like to quote in full, so that if I they make reference to comments, I go scan through am take refresh my memory and stay very conscious, because na very bad thing for person wey don they here for long, to get him/her account red tagged or ignored. That na blo blo burst, penny go o.

Na em be say also, person go they reduce the kind big grammar wey they include for any post here, make AI no confuse think say na em write am o.

SmartGold01
Hero Member
*****
Offline Offline

Activity: 672
Merit: 726


Don't joke with my Daughter


View Profile WWW
April 13, 2024, 10:31:10 PM
 #7

Thanks brotherly for bring this post up here although, I be wan talk about this thing when one reputable member been day attack me for few days like that after everything him come clear am say make i no vex say him mean another thing but, i know say when person too dey accurate with their punctuation marks and the rest dem go say na AI him dey use.
Some people no sabi follow up things because them think say here any place dem go do as them like.
 

.
 airbet 
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
 .

▄████▄▄▄██████▄
███████████████
███████████████
███████▀▀▀▀████
██████████████
▀███▀███████▄██
██████████▄███
██████████████
███████████████
███████████████
██████████████
█████▐████████
██████▀███████▀
▄███████████████▄
████████████████
█░██████████████
████████████████
████████████████
█████████████████
█████████████████
███████░█░███████
████████████████
█████████████████
██████████████░█
████████████████
▀███████████████▀
.
.
.
.
██▄▄▄
████████▄▄
██████▀▀████▄
██████▄░░████▄
██████████████
████████░░▀███▌
░████████▄▄████
██████████████▌
███░░░█████████
█████████░░░██▀
░░░███████████▀
██████░░░██▀
░░▀▀███▀

   
|.
....
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
.
 PLAY NOW 
Samlucky O
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 266
Merit: 186


The great city of God 🔥


View Profile WWW
April 13, 2024, 10:59:28 PM
 #8

Well-done, you do well for this thread you don creat so I been don dey reason this matter since but never implement am. One thing be say make we no dey think say as you be full member or senior member say you dey covered, which no dey like that for here like that. na racist Naim full here and them they look for any slighted opportunity to take spoil person account like you said make people they use piaglarism checker before posting. Make we no go make mistake carelessly piaglarism no get friend or position. from newbie to legendary any body wey ignorantly go do am say him smart, ft go distroy him account. Make we just dey careful even merit matter.

Churchillvv
Full Member
***
Online Online

Activity: 378
Merit: 166


Eloncoin.org - Mars, here we come!


View Profile WWW
April 14, 2024, 01:37:26 AM
 #9

As for this matter of AI generated texts I don dey get one bad feeling say most of this guys for reputation board just get one kind of heart to ruin people account with small suspects we no dey really self, even if na true e no reach to give person reg tag but na their works.

I don also check my writings for AI plagerism checker and e show 38 percent AI generated and this one na because I speck English we I dey use regularly but I just dey wonder how this people dey really determine whether true there own na to just dey trace things wey no make sense.

I don decide say I go dey reduce my rate of mean English because this AIs dem dey loss guard sometimes make them no go implicate you for nonsense.

Cryptoprincess101
Member
**
Online Online

Activity: 196
Merit: 91

★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest


View Profile
April 14, 2024, 05:21:27 AM
 #10

  • If you nor dey sure make you use plagiarism checker websites take check wetin you write.
Some people dey actually know when dem dey plagiarize, but because them just wan do smart and feel say dem fit cheat the system, they go ahead to copy and paste, or even use AI to write thinking they will not be detected. So nor be like say these people nor dey know when dem dey do am, na intentional act to some, they nor need any plagiarsm or AI checker website to know.

Wetin you talk na true, anybody wey use AI make post no say him use AI even for plagiarism sef and e get the one wey Dem call plagiariam paraphrasing even some people dey paraphrase AI write ups Dem no be say na to speak big grammar dey cause am, AI contents get how the write up dey be wey dey different from how ordinary human being dey take dey write.

▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬ ★ ★ ★ ★ ★ ▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬
PLINKO    |7| SLOTS     (+) ROULETTE    ▼ BIT SPINBITVESTPLAY or INVEST ║ ✔ Rainbot  ✔ Happy Hours  ✔ Faucet
▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬ ★ ★ ★ ★ ★ ▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬
Davidvictorson (OP)
Hero Member
*****
Offline Offline

Activity: 966
Merit: 832


Livecasino.io


View Profile
April 17, 2024, 03:18:47 AM
 #11

Wetin you talk na true, anybody wey use AI make post no say him use AI even for plagiarism sef and e get the one wey Dem call plagiariam paraphrasing even some people dey paraphrase AI write ups Dem no be say na to speak big grammar dey cause am, AI contents get how the write up dey be wey dey different from how ordinary human being dey take dey write.
The tin wey de burst ma brain be say if you go the meta board wey dem dey report people wey use ai write you go dey wonder why e be say this people nor fit just write say dem been get small assistance from AI as dem use am as part of their research when dem dey create the topic. Had it been say dem write this one come add the AI wey dem use, nobody go fit hold dem as dem go talk say him don already talk say him get assist from AI. To try to be a smart ass for the forum nor dey pay sha make we all dey use our head.

██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
... LIVECASINO.io    Play Live Games with up to 20% cashback!...██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
AVE5
Member
**
Offline Offline

Activity: 154
Merit: 37

Eloncoin.org - Mars, here we come!


View Profile
April 17, 2024, 07:24:43 AM
 #12

It's just quite unfortunate say such happened to one of us and also unfortunate say we dey involve on such AI usage in the forum when we know the negative outcomes.
Make we too also try to refrain from wetin go indict us to dangers.
I really feel for the dude and make we dey also try to get am right say some of the foreign forum users na racists way no like us Nigerians na em make dem no dey hesitate to judge us in any silly step.
Abi e no clear say dem dey drag our fellow Nigerians in both deserved and underserved scrutinies?
So this alone just need to keep us as reminder for heads so we go dey apply measures of carefulness as we fit bear. The survival of the fittest for us in this forum dey very high volatile but na God win.

Op, I also fear as u bring dis kind matter for a public here because the structure of the thread via the warning and reminding alert message u dey pass here just be like say u dey encourage using the AI which that fit drag those haters more attentions to dey keep our local members on track believing say we dey use that AI format.
Cus to me as long as say this forum dey accessible by other board users, na still public board e be so make we forget the fact 1st say na pidgin language we dey use flow here.

ElonCoin.org    ElonCoin.org    ElonCoin.org     ElonCoin.org     ElonCoin.org    ElonCoin.org    ElonCoin.org
●          Mars, here we come!          ●
██ ████ ███ ██ ████ ███ ██   Join Discord   ██ ███ ████ ██ ███ ████ ██
Pages: [1]
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!