Bitcoin Forum
April 30, 2024, 11:37:51 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1]
  Print  
Author Topic: How prepared are you about the upcoming halving?  (Read 27 times)
Cryptoprincess101 (OP)
Member
**
Offline Offline

Activity: 196
Merit: 91

★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest


View Profile
April 15, 2024, 02:41:12 AM
 #1

We dey expect Bitcoin halving to happen around 19th or 20th of April, 2024 and as some of us know say within this period say Dem dey divide the block reward wey Dem dey give people wey dey mine Bitcoin (miners) every day so as some of us know say after the halving don end say we dey enter bull run wey be time wey so many investors dem dey troop in to invest in cryptocurrencies and prices of these cryptos dey high well well and even pass the highest price wey Dem been don reach before wey Dem dey call ATH (All Time High) so people wey buy and hodl Bitcoin for their wallet Dem dey Happy well well unto say their investments dey carry profits and some people dey decide to sell their coins and wait for time wey the price go fall before Dem go buy and hodl again till maybe another bull run wen the price go high pass the previous one again.

I no say the way the country be now, e no dey easy for person to dey buy dey hodl Bitcoin wey be say hungry fit dey wire you sef and to come buy Bitcoin with small money wey dey your hand no dey easy at all but i wan tell us something say for dis life wey we dey so, manner no dey fall from heaven again o because anyhow wey person plan him life na so in go dey for am for future and before person go achieve great things for dis life na tru determination and to take risk because life wey we dey live sef na risk not to talk of risk wey we wan take to better our future.

Make we try dey buy Bitcoin dey keep for our non custodial wallets no matter how small wey e be because e go dey bad say we go enter dis bull run and people wey get Bitcoin for their wallets go dey enjoy why you wey no get go dey look like olukwu and you go dey feel bad even dey envy other people for something wey you don hear how the odour go be and you come relax dey feel say e no go get head. "Even not taking a risk in life is still risky" because some things wey you for don achieve for life you no go fit achieve again because of fear say the thing fit fail.

My happiness sef na as naira to dollar dey come down to buy Bitcoin come dey affordable because that time wey naira to dollars been dey #1900 fo 1$ I come dey imagine say how person go carry #190k buy Bitcoin worth $100. Like ordinarily e no dey easy at all even if you get too much money but as the naira to dollars don come down like this na im be the best time to even buy as many as you wish no matter the price of Bitcoin now because wen we enter bull run, the price go still high pass like this so you go still make some profits from your investments.

No time wey dey late to invest for Bitcoin o because na volatile asset be that so you no get anything to fear at all because your investment get guarantee say you go make profit in the long run so my people e get one talk wey our parents Dem dey talk say "wen your mates are getting mad, join Dem and mad as well" dis saying no mean real madness but e mean say as other people dey hussle make life better for Dem say make we join Dem hussle too so dat life go better for us too.

Advice no be curse o make we follow people wey know road waka so dat we no go miss road o, as you dey chop make you remember to take some money invest because na dis investment go sustain you for future wen you no go get strength to dey work again so your investments go stand as a backup to make things easier for you dat time. I greet all of Una and make una also give una own opinion on top dis mata wey I raise so.

▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬ ★ ★ ★ ★ ★ ▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬
PLINKO    |7| SLOTS     (+) ROULETTE    ▼ BIT SPINBITVESTPLAY or INVEST ║ ✔ Rainbot  ✔ Happy Hours  ✔ Faucet
▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬ ★ ★ ★ ★ ★ ▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬
Pages: [1]
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!