This my post Dey come from the stand point of anger and for people wey no know wetin SON mean, Standard Organization of Nigeria (SON) na the people wey Dey in charge of monitoring and inspecting the quality of goods and services released to the market and from the look of things, these very organization no Dey active but yet I Dey see their stamp of approval on almost everything wey Dey market because, if you don take time to observe goods like cabin biscuits to several other things, you go observe say, the qualities of these things don drop badly and yet their prices Dey increase wey no Dey right.
Now my problem and concern na if these organization truly Dey work or na just avenue to chop money from government revenue and how the common man fit contribute to improve the qualities of these products.
The role of S.O.N for Naija no pass to check the originality of products and materials wey Dem dey sell, buy or produce for this country. Dem dey help checkmate counterfeit products for the country, but as you talk, na so e just be.
Dem no dey do work wey I dey like these days true true because I notice same thing for many of the products Dem these days, still their stp go just dey der add beauty to the carton or packaging of the product.
E go dey okay if any educated citizen wey see some of these substandard products to point am out either on social media or report am to SON, because many businesses fit fake the stamp just to avoid paying the regulation fees as members of the body.
Also, e fit be say government dey allocate money for Dem but the oga kpatakpata go connive am do anoda tin wey we no know. Whichever way it is, try dey sure say product wey you wan use na better one o, if not go for alternatives and report fake products mostly those wey dey enta belle, to the right authority.