I believe the whole idea of this was to actually give our local production house a boost of confidence
Come to think about it ehn, i no think say government gats close our land borders to help local production, they can support local producers and leave the borders open for competition. Wetin i believe be say competition dey help businesses to grow and improve and e dey also help to control the prices of goods, so whatever we go dey import through our land borders, we go also dey produce locally, leaving the market open for competition.
Yeah that one na true because competition na always watin dey cause many people stir up their game and meet to the need of the people because dem no say if dem no do am other producers go do am. This na similar thing wey happen for the aviation sector as one airline drop price which is air_peace na so the other ones too fast reduce their price because people no come dey reason dem.