Na better talk you raise here, this one na normal thing wey dey happen after the Bitcoin halving event, sometimes eh go drop very low beyond expectations and that go make plenty people to dey panic say them go lose their coins but make dem no fear because the coin go still pump again after a while and I get believe say eh go still set another ATH too, so this na opportunity to buy more, instead of selling make everybody wey dey invest in Bitcoin buy as much as dem fit buy especially for people wey dey ready to invest for long term, this na the right time to buy more so them go fit make profit when the coin go begin pump again. As for newbies wey get small knowledge about Bitcoin, i wan tell una say make una no dey misled by those social media talk, I hope say by now una suppose done know say Bitcoin dey volatile in nature, sometimes eh dey increase and sometimes eh dey decrease too, but when eh decrease make una no go panic sell coins so una no go regret when the coin pump again. Currently Bitcoin na the crypto asset wey em face show pass so eh go make sense to seize the opportunity to invest for that kind asset when the price drop, imagine wetin people wey invest when the coin been dey 18- 20k dey enjoy now.
True talk, na e make e good make person get the idea or knowledge of Bitcoin before we go involved ourselves in it , that is to either invest or trade, so that when we encounter things like market fluctuating at times, we no go see am as new thing again and fear no go dey our body again.
Just like you said, say make they no sell their coins because say Bitcoin don come down and na true you talk so, if only they go get this idea, no investors especially the newbies go dey complain or regret why they dey go rush go sell their coins, so e really dey very important to know wetin we dey do before we go do am.