Every day we hear about the naira going up or coming down.
In the morning, the price of a naira to dollar fit be 1300 to 1 dollar and in the afternoon it may now have changed to 1350. Watching it happen in real time is so fascinating that I wonder how does this price movement mechanism happen.
Abi dem connect these P2P platforms to our Naija stock Exchange or some kind of forex market API? Abi which kind other method way dem dey use take determined and put update for the exchange rated. Abeg I assume say most of us dey use P2P platforms and if you sabi how this thing dey work, I go like make you enlighten me.
Bro, no just allow am confuse you, wetin dy affect the price of dollar and price of naira na just people's sentiment, or I go say na the higher rate of demand or less demand nai dey affect the price, ok make we look am from this angle, you know say as Nigerian wey we be, we dy do more of importation than exportation, so while doing that, we need to get dollar in hand, for the importation of any goods or service to go through, so our demand for dollar dy very high now, and any action like that dy always reflect in the parallel market.
And for economics, we all know say the higher the demand of a goods, the higher the price of the commodity, so as it stands now, the demand for dollar in naija dy too high, the government just dy try all their best to suppress the appreciation of the dollar, which I believe say Dem no go fit sustain am, because the root cause has not been addressed, and until they address the root cause, and the demand of dollars reduced, na so dollar go keep on rising everyday, wether the government like it or not.