Both the government and the CBN government them no know watin them dey talk because how somebody go just wake up one day then talk say nah crypto currency nai spoil this our country economy? The story no clear even for small pikin ear. But watin I know be say as long as say Nigeria is concern, as any new government enter seat nah so the country go dey worst dey go, so our own nah to dey pray say make we just get something doing so that we no go dey too affected if the country worst pass like this.
When I dey talk am say our leaders dey only talk waiting don comot for line and their reasoning to development dey far from them base on how they reason person fit see me as working against government if our leaders they reason well all the human capital development wey don fall and the investment wey them don loot money no fall economy unemployment everywhere, refinery not working this is a clear show say now kakistocracy now our government be people with least knowledge in leadership.
If the world leaders never see crypto as what is spoiling the world economy I don't think say our government dey reason well for this their matter, crypto currency don go beyond where one country go come out to stop our government no dey make use of opportunities that's why every sector dey get leakage until we join moving train nothing go work.