|
July 15, 2024, 10:08:02 PM Last edit: July 15, 2024, 10:22:09 PM by CryptSafe |
|
This information here is very important to talk about because e really concern we wey dey into crypto. This na one of the mistakes crypto enthusiasts dem don do before wey make dem lose their money and account at the same time. I been don encounter something like this before but till now I still dey wonder weda na wetin cause the delay for the payment to reflect for my account or na wetin. E get the transaction wey I do years past. I been dey in a haste to make payment for something wey make me I no really settle down do wetin I suppose do.
I go click on account wey neva do upto 100 deals I no know because I no really do my prior observations on the account trade volume. The guy make payment message me say him don pay, me I never see anything I tell am to send proof, as him upload am, na there I see wetin him write "CN PYNT" omo na there my eye clear immediately, I come take time look the account come discover say na new trader, fear don catch me. I just tell am straight say I never see anything and upload my bank account statement for them to see tell them the possible reason to be wetin the guy write, say I no go release the coin till dem credit me. Customer complaint blame the guy tell am say make him calm down say after 24hours if I no release am make him call their attention. Na the following day the money drop as P confirm, I upload am make dem too see the time make e no be like say I dey whine dem and dem see wetin d guy write from my side too.
Why i really explain wetin i experience be say na mistake wey dey happen wey we really no dey take note of. If you dey trade make you try calm down look the available traders, look into their trade volume that one go guide you know who you dey trade with because some account fit be agents wey just join dey look for who to jala while some na newbie wey never too sabi the platform well. Dem go just write wetin no good for description wey fit put you for trouble. Whenever we dey try to trade make we take time do the needful so that we no go begin talk had I known after every.
|