Una too get wahala…you cannot please everybody. Some people say the local board no resemble local board because say people dey use oyibo dey talk even though we been don agree before hand say na so e go be. Now you don bring another one say the pigin sef dey confuse you. I no know wetin you want make we do about this your complaint cos warri people get as them dey talk, Ph, Lagos and other places get their own way of speaking.
Abi, no be lie you talk I been don even forget say warri people dey here no wonder e dey hard me to understand some pidgin cause even when I been dey with worry person for school en tongue na, no go area if the guy dey talk and e come happen say na the first time you dey stay with am bro you no go understand any shit. But as you don make me know say different people dey here I don understand say na tribal something ( tongue issue) so I go try my best to cope and make everybody dey try put am in a way person go understand waiting them dey cap.
I am not saying that they should stop speaking pidgin. In fact Na the pidgin dey show say na we (Naija) mount here.