Happy weekend everyone. So this question da important because most people da enter crypto now with the wrong mindset like say na get rich which scheme. So maybe this one go help one or two new people. For me I don da crypto for 2 years now..and first thing I learn be say you go read book tire. E be like school. No be for lazy people ahaha. Secondly no need to rush and remove fear for your mind.. make we hear una stories..
D thing be say most of d peopple wey get that kain mindset na people wey be say dem see person wey crypto don bless demgo com think say na so the mata dey be untill dem com enter dee say e deep pass like dat, dem no know say d people wey crypto dey bless at some point don dey into the crypeto mata since no be today so dem dey earn reward of wetindemd on dey hustle for long years but dem na go wan run am fas fas.
wetin dem supposed know be say for you to make money from crypto no be one day somthing wey be say na d same day you enter you go start to dey make d money, except say you get luck like me when i fes enter crypto, my friend wey show me been direct me say make i buy doge coin dat time and as i run am, e give me sharp funds but everybody no fit dey lucky like dat so usually na say make you try understand wetin you wan do fes before you start.
Cryptocurrency is not for the weak neither is it for the dull, what happened is that market get face and before you go enjoy the market find way know the faces wey e'm get before jumping into market. Like as e be now people go think say those people way invest during bear run go dey cash out and na that time dem go wan go investment for wetin people don day already cash out.
This one na wrong targeting because if you invest at the wrong time you get wrong results although not entire wrong results but e go take you time to recover the ones you lost but, just focusing knowing when the market is a the right face of investment. Like this if person wan investment s/he still get the chances to invest because we never fully enter full bullrun instead buy as little as you can hold am and wait for the massive iceblock next year.