With watin you talk I understand but you suppose to dey specific with the kind of coins wey you dey refer as crypto currency, if nah Bitcoin wey you try talk, mention am so that we go understand you properly.
Make I use the world Bitcoin.
Bitcoin nah better investment source because nah good store of value and no body fit control am as e dey decentralize. All investments get risk and e better make person invest for something wey no body fit dey control. And again, all those other coins wey you mention dey learn from where Bitcoin dey as bitcoin nah the top leading coins for the crypto space.
To invest for Bitcoin you no really need much money, all you need nah the money wey you go fit afford. Bitcoin investment no require any specific amount for someone to get before em go invest for Bitcoin. Person fit start with as low amount like 5k naira sef but the important thing be say nah for the person to keep am up and make em no invest today then stop tomorrow.
Wen we talk about security, that one nai be the most important thing for any bitcoiner, as you get Bitcoin for your wallet you need to protect am with everything possible because nah your asset be that. Still e no goo for anyone to keep Bitcoin for exchange for long period of time because exchange no be wallet and those exchanges them dey centralize.
As investment dey so person need to know the kind of investment em won do and how em go take do the investment constantly and how long em go do am.
The person need to choose the coin wey em won invest in and the wallet em go use safe the coin and how much em go dey put inside the investment with how em won take dey buy, wether nah daily, weekly or monthly. If person no plan am like this em no go last for the investment because em no plan well. So these things sef nah also important things wey person need to know before em start.
Ways to use invest for crypto.
2. Mining.
En involve to use special hardware to solve mathematical issues so as to earn new cryptocurrency as a reward.
You get plenty errors for this your op thread but this one I gets quote am separate because e no aline with anything wey consern investment.
Trading and investment nah 2 different things (know am now),
you can also visit this link to know the difference between trading and investment.