If anyone dey one work and steady income dey come in then make dat person invest and dis your story sef e no dey clear for me too because if that your friend was not working as you stated in the story and he run away with his friend money wey the friend trust am and handover the money give. And him go invest am for bitcoin for how many years? Stories like this we need details how it how it happened. Because e go dey hard for someone wey e no dey work to invest in bitcoin because he must chop. If him dey do small small work after investing in bitcoin to save di investment then na good thing him do.
But for stealing him friend money na very bad thing be dat and nobody go trust am again. And me I no support weti him do even though him don make am foe life.
@Mate2237, Read well before u comment. de guy no steal him friend money, na hm friend handover de money give am to spray am for strippers body (ashawo wey dey dance naked) to catch cruise, him con realise to waste dis kind amount of money for strippers ee better make him commot with that money take do something wey go benefit him life than to lavish de money unnecessarily for woman body. This naija ee get friends and even brothers wey dey rich to help out their Padi man na big issue to dem but instead dem prefer to buy u food, alcohol and carry u go club pay ashawo for u. But na go realise say if that kind person nonfit help but dey lavish money unnecessarily wetin be need to enjoy wey u no get one naira. That guy sharp use him head, that one no be stealing guy.
You think say I no understand your post. Can you define "STEALING" for me? I don't support bad thing oh. His friend asked him to use the money spray someone and him run away with the money. If you don't know you have to know dat na so yahoo boys dey dem no dey give money to their friends or house people but to girls and wears. But I still dey talk say weti your friend do, him don loss reputation from many people even though he is a big boy. And you don't have to follow his footsteps.
And before you create this thread like this if that kind thing happen to you, you go do am as well. And with that I won't trust you here as well. And here be believed in trust and reputation. And you don't ha e to repeat your story to me. I don't like what your friend did.