Dem say national grid don fall again oh, e be like e don turn to monthly occurrence for this country. Blackout everywhere, people dey complain say their area nor get light, fuel sef dey very expensive and people nor fit dey run their generator for hours again. Business owners wey need light to run their business dey complain.
Inside this year alone, the national grid don fall more than 10 times, before we go reach December, e go complete am the 12 time.
All this wahala boils down to the fact say we no get enough power generating plants for our country, the capacity of consumption is large so we need more plants and I no sure say this government ready for something of that nature.
What I would advise is for individuals to look for alternative source of energy especially like solar panels and inverter batteries to store enough for house usage, depending on this national grid might just spoil a lot of things for you, if you're a business person or a poultry farmer.