We recall last year January wey our country law makers been detain Binance executive. As at today wey be Valentine's day
daily post dey report say Tigran Gambaryan Binance executive say him fit mention three law makers wey been wan take bribe from am when them been detain am. According to wetin him talk, him say na $150m dem been wan collect as bribe from him hand.
Him mention Peter Akpanke and Philip Agbese as two out of the three members of House of Representative wey been interrogate am after DSS been tell am before the meeting make him do anything them ask am to do that him fit go him way and the matter enter gutter. This incidences just the tarnish our image for the international market and our law makers no even care.
Baba this information self way Binance release, trust me them for no release am, because nothing go still happen, in fact by tomorrow morning you hear as them go release pressure statement deny say them no know watin Binance dey talk. If we where in a serious country, EFCC would have launched serious investigation by now..
Omo the country matter just tire me, I still hear for this Binance matter, say APC been wanting use Binance take get information about their opponents way dey another party, then been want use those information witch-hunt them.