Bitcoin Forum
August 03, 2025, 02:29:39 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 29.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1]
  Print  
Author Topic: Where This Generation Dey Head Go  (Read 69 times)
Mansoveh (OP)
Newbie
*
Offline Offline

Activity: 4
Merit: 0

View Profile
July 10, 2025, 10:08:19 AM
 #1

Omo, where this country dey go like this? E be like say Nigeria don dey head one kind direction wey no clear. This our young generation no get patience at all again. Na just yesterday internet begin scatter with news say one SS1 student buy Mercedes Benz and I decided say make i share to this place. Him papa tell am make e return the car, but guess wetin happen? Him own friends dey advise am make e no listen to him papa. Imagine that kain thing!

Na from there person go know say bad friends fit destroy person life. Instead make dem support the papa, dem dey encourage the boy to go against him own father.

Make we reason am weller where SS1 boy wan see money take buy Benz if no be Yahoo or some kind illegal move? Small pikin wey never even finish secondary school don dey do pass him level. Now small children don dey ask for “update” up and down and we all sabi wetin that “update” mean.

The matter really weak me. Things don spoil reach this level. We gats be very careful with the kind people we dey call our friends. If we no watch who we move with, we go just use our hand enter serious gbege wey fit destroy our future.

Make una watch the video too https://x.com/yabaleftonline/status/1942486896522792968?s=46
WhoYouCantKill
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 197
Merit: 123

View Profile
July 10, 2025, 02:33:37 PM
 #2

No be wetin you dey reason wey all this young one's dey reason o, most of them just won show off and to impress other people too.
Na e make most young one's just won do everything possible just to make, that is to get those things wey their mates dey get, instead of them to dey think how their lives won be, how their future won be, look for something wey they go invest wey go benefit or better their lives forever.
But, them no dey reason like that, na just to feel among na them know and e good make person get better friends because as the generation be like this, young one's dey hardly listen to wetin their parents or elder one's dey talk, na wetin their friends dey talk na e dem won dey hear, which is not right but if one get better friend, e no go allow make person go wayward.

Joy_learns_crypto
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 200
Merit: 145

View Profile
July 10, 2025, 02:50:15 PM
 #3

This are news from blogs, all these blog do is post news and gist to grow there account, yes they are entertaining. But for wetin we Dey do for this forum this kin gist no be our matter. Here no be gistlover or Mazitundeednut page.

Dulen007
Jr. Member
*
Offline Offline

Activity: 93
Merit: 5

View Profile
July 10, 2025, 03:23:59 PM
 #4

Omo, where this country dey go like this? E be like say Nigeria don dey head one kind direction wey no clear. This our young generation no get patience at all again. Na just yesterday internet begin scatter with news say one SS1 student buy Mercedes Benz and I decided say make i share to this place. Him papa tell am make e return the car, but guess wetin happen? Him own friends dey advise am make e no listen to him papa. Imagine that kain thing!

Na from there person go know say bad friends fit destroy person life. Instead make dem support the papa, dem dey encourage the boy to go against him own father.

Make we reason am weller where SS1 boy wan see money take buy Benz if no be Yahoo or some kind illegal move? Small pikin wey never even finish secondary school don dey do pass him level. Now small children don dey ask for “update” up and down and we all sabi wetin that “update” mean.

The matter really weak me. Things don spoil reach this level. We gats be very careful with the kind people we dey call our friends. If we no watch who we move with, we go just use our hand enter serious gbege wey fit destroy our future.

Make una watch the video too https://x.com/yabaleftonline/status/1942486896522792968?s=46
No be today all these kind things begin dea happen for Nigeria. You go see pikin wey suppose dea suck breast with phone way big pass im parents salary. If actually the story na legit, then I go say the Father of the child na a man of integrity and good morals. Cox na only a man of such characteristics go get that kind mind to ask im child to return the car keys from where I'm get am. Some parents for Naija, go tell town crier, to inform the whole village to come witness waitn baba God don do for am. Then go buy drinks for the whole community, carry powder full body, sing songs of praises! Just because of waiting, their child don buy car without trying to find out the source the child take get money buy the car.
Pages: [1]
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!