After all the stres wah student dem go tru just to write dey waec exams i dy different schools.
The waec board come dy call them back say make dem recheck dy result back say this year exams the result too clean or watin come be the thing.
Omo dis country matter just get as e be, make I no lie you, nothing Dey work for dis country, how dem go release result, students don Dey check already, after like few days, Dey come talk say error Dey d first result wey dem release, and students will have to go and recheck there result again, seriously e Dey crazy to be, because as dem know say error Dey, dem for never release am now, Dey for just fix everything before dem release am.
I sabi person wey pass mathematics as dem first release the result, as dem say make dem check again, we him go check, I see say na E8 e Dey show, person wey don Dey happy before, Dey don spoil everything for d guy.