 |
September 07, 2025, 07:22:35 PM |
|
Nigeria win Rwanda 1-0 for inside Godswill Akpabio stadium Akwa-Ibom state Nigeria, but i si se di match na narrow escape for Naija boys bcos dem no fit score more goals.
For boll possession Naija boys pass dem sha, wan thin weh worry dem na Victor Osimen weh com wunjur for first half com make dem no fit score more goals.
But thank God se dem win di match , dat na di most important tin .At least wi don quality.
I go se make Naija boys put more effort so dat wi go go far for di competition bcos wi de go face countries weh de cajad pass di wan weh wi don face, so make wi try if possible sef make wi carry di cup . Bcos i blif se dis wan na awah turn.
|