Lessons we go carry from these be say, Dis kind dip no be end — na correction after sharp run, Big players (institutional investors) still dey put money inside, nah moment to hold strong — no sell in fear. If you comot now, you fit lose the bounce-back.
Normally if u understand the unpredictability of bitcoin price onto say na volatile asset this very dip no be wetin supposed be a tin to cause panic among users except for the traders way dey study the market to sell at a spot. Na dem go feel am while investors dey even target to by the dip. So what if we enter bear market way the market go go dipper how those way dey panic go react? Halving still dey way price go Slash in two.
I strongly believe say the bull still dey on and the price go rise again and make we no forget say we dey anticipate for $150,000-$180,000 atleast to close this season bull cycle. So make we dey careful and not sell at fear to avoid regrets when the price begin soar again.