 |
Today at 09:02:23 AM |
|
Anytime wey you want to do business with anybody make you make sure say una get a solid agreement before una start. To make di agreement to get legal backing una need to involve a lawyer wey go write a comprehensive partnership deed for una. Di aim na to make official every partner's contributions, positions and to know how to share profit.
Why I bring dis matter up be say I know two cousins wey be best friends before, as I de talk now dem families be serious enemies. One of di cousins get land for better site but e no get money to develop am. Di other cousin wey get money begin to de fund di building of di house wey don reach completion stage now. Unfortunately di cousin wey get di land come die and di wife and children come claim di house as di property of dem late father. Di cousin wey dem take im hard earned money to build di house no get any legal documents to show say na him money dem take de build di house. I hear say di matter don enter court case. Assuming say di cousins comot familiarity and get a legal document wey clearly state di contributions and di entitlements of each partner before money begin to enter problems no go de
Money matter na serious matter, e de cause problems for relationships so to avoid am e de better to have a solid agreement wey no go be ordinary verbal agreement if na business matter. So far na business matter di solid agreement supposed to be in writing with each partner's signatures, possibly make a lawyer write di agreement for dem. Incase of problems in the future di partnership deed go solve di matter.
|