 |
October 15, 2025, 10:02:26 PM |
|
Good evening my fellow naija members I dey very happy to identify this local board after a registered almost a month now and i just dey go through different boards for the forum before i come see say naija local board dey for the forum where people dey interact with both English and pidgin. First of all, i want to appreciate the founding fathers of the local board because i don read the history already come see the efforts of some prestigious legendary members of the local board, una thank you very much for making it possible for we to have a local board where we can be more conversant with discussions that concerns the forum and also about things wey dey happen for we country.
I don also go through the introduction thread of the local board, i read so tay my eyes begin pain me because the thread dey very voluminous and i come see say people wey get skills for this local board plenty well well as them put am for their introductory write-up and dey also included States of origin which means say from there we fit know our colleagues wey dey within the State wey sef dey too, na so i come say make i come up with the idea of creating a service thread wey e be say people fit dey post their skills for there so that anybody wey dey interested and need their services fit just send dem PM and we fit even get people wey get professional skills from the local board.
I know say dis forum na anonymous forum wey be say e no too dey good for people to dey reveal their identity but no how wey everybody go fit dey anonymous for the forum since e get people wey also introduce other people for the forum which mean say one way or the other, people still know themselves for the local board. Na just suggestion i give sha o abeg make una no bash me, if e no make sense then make we just trash the idea. My people wetin una think?
|