My beautiful people, I greet. I bin dey surf the net when I stumble upon this news so I decide to bring am come here to hear and read our different opinions on the matter.
Nobody be stranger to how unstable we local fiat, the naira, be and as such so many people don lose hope on whether beta go ever dey as relates to the growth and value of the currency.
Recently, according to a review by
Quartus Economics, them feel say need dey for the CBN to look into the matter of introducing #10 and 20k notes citing their reasons as "helping to restore the naira's portability and helping to reduce rising cost of cash transactions".
Now, I no wan know the credibility and trust wey this Group known as Quartus don accumulate over the years when e comes to financial advice, but wetin I know be say this suggestion or whatever them dey try give CBN nah very rubbish one because with how economy dey, imagine how e go be if person loss 10k just because e dey as a note. Instead of the reason wey this people bring as way to help, e go cause wahala.
We get so many matters to worry about; the issue of the debts and high rise of poverty wey dey bite man need to be considered yet them still dey bring more things wey go frustrate the poor man. Abeg how una see this matter? E go good make CBN reason this talk?