Good day my pipo, you know at some point as a beginner, you go dey wonder wen you see pipo talking about OP_CHECKSIG or OP_RETURN, Wetin e mean?
Nah Wetin make me create the thread bedat make I fit explain Wetin dem dey mean for beginners make dem get basic understanding of Wetin OP_CHECKSIG or Wetin OP_RETURN dey mean.
Wetin be OP_CHECKSIGOP_CHECKSIG nah opcode for bitcoin scripting language , wey dey part of transactions validation process and e dey verify whether the signature for a given transaction input nah valid signature and to make sure say nah the owner of the money Nahim dey spend am.
To confirm say the pesin wey wan spend the bitcoin get the private key associated with public key provided in the transaction, OP_CHECKSIG dey check the given signature whether e dey valid for the given public key.
OP_CHECKSIG dey collect two input from the stack, which are: The signature (wey dem use the private key create) and The public key wey dey associated with the bitcoin address. And OP_CHECKSIG dey output a true or false value (Boolean value) wey dey show if the input is valid or not.
Where OP_CHECKSIG dey applicable •Transaction Validation
•Pay-to-Public-Key-Hash (P2PKH)- The most common script type
To validate the standard of a bitcoin transactions, OP_CHECKSIG is used. The wallet software wey pesin dey use go create a transaction wey contain the necessary signatures, wen ever pesin dey try to spend him bitcoins. The Bitcoin nodes go com use OP_CHECKSIG to verify the validity of these signatures before dem accept and add the transaction in a block.OP_CHECKSIG nah very important part of bitcoin security wey dey keep the security of bitcoin network, by making sure say nah only the rightful owner fit spend him bitcoin.
Note: This is just a thread to explain what OP_CHECKSIG and what OP_RETURN basically mean for beginners, anyone wanting to know more about it can learn from various ebooks and websites.
You can Read more here:
https://en.bitcoin.it/wiki/OP_CHECKSIG
Explaination about what OP_RETURN is will be on the next reply.