We dey see a new wave of AI + Crypto projects wey dey show up, projects like trading bots, decentralized AI models and smart contract automation.
E come dey feel like say the two sides were meant to meet: blockchain dey provide transparency and trust, while AI dey bring intelligence and automation.
But the koko be this, we fit really trust AI for this kind decentralized system? If AI begin dey make important financial or governance decisions, shebi that one fit create a new kind of centralization.
Perhaps the future no be about "AI replacing humans ", rather AI helping decentralized systems to scale safely and more efficiently.
Wetin una think, AI na the next revolution for crypto abi na just another hype cycle wey go still fade and kpai
Trading Bots no be something wey Dey new, trading bot don already Dey before, e no be new wave at all. Ai go be the same thing as e Dey to us na so e go Dey to cryptocurrency.
People go use Ai well for cryptocurrency but it’s not trying to replace big coins like bitcoin. Ai fit no fade because it is something that has a future.