I never really see anybody wey boldly say him Dey accept bitcoin for transactions for we country but the truth be say, most of these stores and people fit Dey accept cryptocurrency as a payment option but in most cases, na you wey be the buyer go try propose the offer and if the seller Dey inclined, dem go accept to receive your payment in crypto.
I understand say most of the exchanges wey government been sanction go don Dey operate again which means say dem Dey aware say crypto transactions still Dey go on for the country but I believe dem Dey profit from am na why dem never wan vex but I believe say a lot of people and stores Dey fear to openly accept bitcoin and other cryptocurrencies as payment option.
People dy collect Bitcoin Oooh. Most of this modern auto guys wey dey sell cars, them dy accept Bitcoin payment but the catch be say, them go say make you send am go their Bybit wallet where them go see am immediately. As you they pay them, them go concert the money go usdt or them go directly swap am go fiat and keep their money. Them no dy keep the Bitcoin as we dy really think like that because na part of their revenue wey dem go carry buy another car again.
If you enter all this Boutique stores wey boys them dy sell cloth, dem know say all this youngings dy get Btc for body, so them dy guide with their wallet mount. The advantage be say, all this Pablo self dy tip them join when them wan settle them. So all this dy but as naija dy, u no fit go dy loud am say you dy accept Bitcoin due to security reasons and also government wahala. Nobody want anything wey go cause any wahala got am.