 |
December 01, 2025, 08:33:40 AM |
|
For this festive period we need to take our safety as our utmost priority and every other day, because Wetin dey happen this ember month e don dey pass be careful, this time around, Pls if u wan enter KEKE NAPEP or Taxi, and the rider or driver con use any piece of cloth or handkerchief take clean d back seat for u make you sit down, abeg nor sit down if possible use your own cloth clean am by yourself, some of them go intentionally pore water for the sit con do as if them dey clean am. This one na new method wey don Dey use take use people for ritual or do am the way you nor go fit say anything until them carry you go where dem dey go. E Dey serious oh... And again, if anybody stop u con ask if u dey interested to buy their perfume con give u paper to perceive as sample, abeg nor allow am reach your nose. This one too na another method them Dey use. Them don put drugs for the paper wey go make you pass out then them go rub you or do worse things who knows, this message so na confession from 4 guys wey police catch for the process, make we try dey careful this period oh because na who dey alive they enjoy life. Make those of us wey come across this post try notify our loved ones and friends.
|