Op I tink u really know say this kind discussion good for we local board na y u bring am here bcos na only we we the Africans with dilution mindsets say our way forward and backward dey tied on spirituality.
Those timid and diabolical ones go act like dem dey try their best to breakthrough poverty but the hands of the enemies from their villages and ancestral curses na em dey fight their success. Those way dey practice witchcrafts also believe say another enemy of process power na em dey bewitch their progress.
2026 will not magically become your year just because the calendar changes, it's your decision that brings the required result. Not wish, not hope, not prayer but decision to make a change by doing things differently through doing away with excuses, laziness, procrastinating, dependant of relatives help.
Of all, na efforts and consistency put to work na em be the koko of the breakthrough, some dey also make decisions from the beginning but for half way dem dey fall weak and give up bcos dem feel say the little or certained efforts dem make supposed bring dem positive results.
Also to have knowledge of wetin u dey invest or wetin u dey indulge on before u venture in na also wetin we need to actualize to make success.