This people I no really understand how dem they carry get person number Abi dem they spend money buy am just to they spam person dm with this type of message no be only for whatsap I don come across am even for telegram eh they really happen, once’s I just see welcome message say “I’m from this and that company” the next thing I go just reply the person nah make eh carry him business enter another side, nah straight up report and blocking I they give them.
To get people number dey very easy na. Like this if I be scammer I fit just collect any of my friends phone say I wan check something, from their I fit collect people number wey dey important without your notice from their dey send those numbers message. Apart from that e get some Whatsapp group wey Dem fit add you wey you don drop your number for any giveaway and e fit be say one of your friends for their fit be scammer, him fit collect all those numbers dey enter ona one by one. Even for Facebook your number dey. So no even reason am Because no be only you dey use your number, provided say e dey visible to everyone to call you, anybody fit use am against you online Bitcoin private key wey people no fit get anyhow.
The thing be say make we just dey ready for scammers because Dem go surly come. No even dey supprise to get this kind message from scammer because your number be like public key wey anybody fit access. When scammers enter your dm just dey careful make you no go dey too fast because Dem dey smart, and You fit no no the kind format Dem dey carry come since Dem dey upgrade everytime.