Like you all know Leverage amplifies losses as well as gains, which means that using leverage can literally increase the risk in your investment same time increasing the reward too (ROI) . But in time like this the market is somehow (given bearish vibe) a lot of folk are going to get liquidated, due to wanting higher returns.
I feel say some people wey Dey involve themselves in leverage trading na just greed Dey disturb them. Some people wey Dey trade futures no really understand Wetin e Dey about self, they just think everything is just long and short, dem no get proper knowledge self. The main reason why people Dey do leverage trading na just because of the money, dem believe say Dey go fit make quick money from that side, but dem no talk go d risk side.
E better make u Dey Dey ur spot trading, if u Dey market and e Dey against u, if d money wey u Dey loss don too much, na to hold the coin till when he bounce back before u go sell am, but if na future trading, if d price don reach liquidation level, na everything wey u use enter d trade u go lose.
If u Dey into future trading, u go Dey win and lose, but if u come do plus and minus, u go see say money wey u Dey lose fit don pass Wetin u don make self, so e better make we just Dey spot trading make we get peace of mind.