Exactly, if person no get mind, make them comot body o because this Bitcoin of a thing no be for the weak o, which person no suppose carry am play, but gats to be determined and serious about am, na why people need to understand how the thing dey, before they fit dey make decision, so that they no go make decisions wey go later result in regrets and disappointment, and also Bitcoin no dey guarantee one quick profit, the earlier people understand that, the better for them because most people dey enter this investment in Bitcoin for the quick profit, which e no dey work like that.
First of, any pesin wey don decide say em wan invest for Bitcoin, the pesin gats reason the future, the wey I mean be na long-term, Bitcoin investment no be short term, many people wey don leave the industry na because wetin them carry for mind enter, as e no come work like that, na em dem twama, as we don see how the go the go, Bitcoin don dey for a long time, and if we consider how long Bitcoin don dey like this, and the value as if now, we no get any option than ro call am baba, but it takes patience and discipline for any pesin wey start since then to still dey till now, although you dey right dey Bitcoin no be for weak minds, because no be by chocho na to start and hodl till the end na em be the koko.