I no dey see people talk about this online ABIT everyone just dey pretend like say this no be issue at all?
Lol...I understand ur concern but dat article na fresh from d oven as I see d date sey na today's date e carry. To talk true, dis thing don dey pass be careful. Des politicians nor really want make we dey financially independent. Dem want make we continually dey rely on dem to earn for a kontry wey jobs nor dey. Wan day go be wan day and all des dem nonsense acts to suppress d people go end.
My dear, eh dey pain me say instead of our country to go forward we dey go backwards as the year dey go, wetin dey pain me pass na say people go still get mind support this evil and selfish APC government for election even after dem they do everything possible to drag us backwards, eh come dey make me wonder who curse Nigeria cause eh be like the curse too strong.
We dey claim say we be gaint of Africa yet we no dey even do like giant cause of bad government and their yeye policy, government wey no want the progress of the country and citizens, even as we dey try help ourselves through crypto since dem no wan help us, dem still dey try steal from our hard efforts through rubbish policies,
No be juju be that?